93
Na God Bi King 
 
1 God na king and en glory wey dey shine well-well,  
kover evriwhere.  
True-true, God don kover ensef with glory, strent and pawa.  
Di world stand gidigba  
and nor-tin fit shake am.   
2 My God, yor throne don dey even before Yu kreate di world.  
Yu yorsef, don dey forever and ever.   
3 My Oga God, even doh rivers dey full  
and make nois like tonda as dem dey go up-and-down,   
4 Yu wey dey up, strong pass di waves and river wey dey rush with speed.  
God get pawa pass all dis tins!   
5 My God! Nobody fit shange yor laws!  
Yor kingdom dey holy and Yu go rule forever and ever.