87
Jerusalem Song 
 
Korah Shidren Song 
 
1 Di town wey God build by ensef,  
dey for di holy mountin.   
2 God love Jerusalem  
pass any oda town for Israel.   
3 Si as pipol dey tok good tins about yu Jerusalem  
wey bi God town!   
4 I go kount Egypt and Babilon  
join di towns wey know mi.  
I go still kount Filistia and Tyre  
plus Ethiopia town join dem.  
All of dem dey sey  
dem born dem for Jerusalem!   
5 But for Jerusalem real pipol, odas go sey,  
“Una dey enjoy o-o, bikos una bi Jerusalem pipol.”  
And di Most High God go bless di town by ensef.   
6 Wen God dey kount and rite en pipol name for en book, E go sey,  
“Dem born dis ones sef for Jerusalem.”   
7 So di pipol go blow trumpet kon sing sey,  
“Na Jerusalem bi di hope wey wi get!”