8
God Glory And Man Honor 
 
David Song 
 
1 Oga awa God, yor greatness full di whole world!  
Yor glory high pass di heavens.   
2 Yu don tish shidren and small pikin,  
so dat dem go fit tok about yor pawa  
and how Yu take silent yor enemies and doz wey dey oppoz Yu.   
3 Wen I look di sky for nite kon si di work wey Yu do;  
di moon and di stars wey Yu keep for dia place,   
4 I dey ask mysef,  
“Wetin pipol bi wey Yu dey tink about dem?  
Na ordinary human being Yu dey kare about?”   
5 Yu make dem bi like Yu  
kon give dem glory and honor.   
6 Yu sey make dem kare for evritin wey Yu kreate,  
bikos Yu put evritin under dia kontrol;   
7 all di animals,  
both wiked and di ones wey nor wiked,   
8 di birds for di sky, di fish for sea  
and evritin wey dey swim for wota.   
9 Oga awa God,  
yor greatness full di whole world.