75
Na God Bi Judge 
 
Asaf Song For Di Kwayamasta 
 
1 My God, wi tank Yu!  
Wi dey tank Yu bikos Yu dey near us  
and pipol for evriwhere dey tok  
about di wonderful tins wey Yu dey do.   
2 God sey, “Wen di time wey I choose don rish,  
I go judge pipol.   
3 Di eart go shake and evribody go fear,  
bikos na mi make di foundashon.   
4 I don warn proud pipol sey, ‘Make dem stop to dey make mout!’  
kon tell wiked pipol sey, ‘Make una nor dey happy sey una don win!   
5 Make una nor tink sey una don win di fight  
or karry body up wen una dey tok.’ ”   
6 Viktory nor dey kom from east or west  
or from di wildaness,   
7 bikos na God dey judge!  
E dey bring one pesin down and karry anoda pesin up.   
8 One cup wey full with wine wey dem mix with spice,  
dey for God hand and E pour am for di world.  
True-true, all di wiked pipol for di world  
go drink from am till e finish.   
9 But for mi, I go always dey tok about wetin Yu don do;  
I go sing and praiz Jakob God!   
10 God sey, “I go distroy wiked pipol with dia pawa  
kon give viktory to pipol wey dey fear mi.”