67
Tanksgivin Song 
 
David Song For Di Kwayamasta 
 
1 Make God show us en favor and bless us!  
Make E always dey happy with us!   
2 Den pipol wey dey for di world go know wetin Yu like;  
all di nashons go know how Yu take diliver yor pipol.   
3 My God, make evribody for dis world tank Yu!  
Make all di nashon give Yu praiz!   
4 Make strenjas happy well-well, bikos Yu dey judge pipol matter well  
and na Yu dey rule di world.   
5 My God, make evribody for dis world tank Yu!  
Make all di nashon give Yu praiz!   
6 All di seed wey dem plant dey grow well for di eart,  
so make di Oga awa God, bless us!   
7 Make E bless us,  
den evritin for di eart go gi-am di honor wey bi en own.