61
Prayer For Proteshon 
 
David Song For Di Kwayamasta 
 
1 My God, make Yu hear as I dey kry!  
Make Yu hear mi as I dey pray for help!   
2 From di end of di eart, I kry kom meet Yu for help,  
bikos trobol don make my heart heavy.  
Karry mi go di high mountin,  
where I go for dey save.   
3 True-true, na Yu dey save mi;  
my strong towa wey dey protet mi from my enemies.   
4 Make Yu let mi stay yor temple forever,  
den I go dey save under Yu.   
5 Yu know wetin I promise  
and Yu don give mi di reward  
wey Yu dey give pipol wey dey obey Yu.   
6 Mi wey bi king, make Yu give mi long life,  
so dat I go si my shidren-shidren!   
7 Make di king rule with God proteshon forever.  
Make yor love wey nor dey fail and faithfulnes, keep di king.   
8 Den, I go dey sing praiz yor name forever  
kon dey do wetin I promise Yu.