54
Prayer For Proteshon From Enemies 
 
David Song For Di Kwayamasta Wen Zif Pipol Go Ripot Am 
 
1 My God, make Yu kom with yor great pawa kon save mi!  
Make Yu defend mi with yor strent.   
2 My God, make Yu listin to my prayers.  
Make Yu listin to mi as I dey beg.   
3 Bikos strenjas dey attack mi;  
wiked pipol dey try to kill mi and dem nor kare about God.   
4 But na God dey help mi.  
Na God dey keep my life!   
5 Make evry wiked plan wey my enemies dey plan,  
turn back go meet dem.   
6 I go just give Yu sakrifice on my own!  
My Oga God, I go praiz yor name, bikos e dey good and   
7 Yu save mi from my trobols  
kon help mi defeat my enemies.