52
God Judgement And Grace 
 
David Song For Di Kwaya Leader. E rite am wen Doeg from Edom go meet and tell Saul sey David don go Ahimelek house. 
 
1 Yu wey tink sey yu strong,  
why yu dey karry body  
for di bad tins wey yu dey do?  
Yu nor know sey God love dey always protet mi?   
2 Evriday, na how yu go take distroy pipol yu dey plan.  
Yor tongue dey kut pipol like razor blade  
and yu sabi lie well-well.   
3 Yu like bad tins pass good ones  
and yu love lie-lie pass trut.   
4 Yu wey dey lie well-well,  
yu like to distroy odas with yor words!   
5 But God go distroy yu wons and for all.  
E go remove yu from yor house  
kon distroy yu from dis world.   
6 Doz wey dey do wetin dey rite,  
go si am kon happy.  
Dem go laf dey sey,   
7 “Si wetin happen to dis man wey nor trust God  
and tink sey e strong.  
E trust en money kon dey happy  
for di wiked tins wey e dey do.”   
8 But I bi like olive tree  
wey dey grow well inside God house.  
I go always trust God love wey nor dey fail.   
9 My God, I go praiz yu forever,  
bikos of di tins wey yu don do.  
I go always dey trust Yu,  
bikos pipol wey dey obey Yu,  
know sey Yu dey good.