41
Man Wey Dey Sick, Prayer 
 
David Song For Di Kwayamasta 
 
1 Na blessing go follow doz wey dey do good for poor pipol!  
God dey always save dem from trobol.   
2 Make God protet and keep dem alive.  
Make E make dem prosper for di land and save dem from dia enemies.   
3 God dey kare for dem wen dem dey sick  
kon make dem well again.   
4 My God, I dey pray sey, “Make Yu sorry for mi.  
Make Yu heal mi, bikos I don sin against Yu.”   
5 Na only bad-bad tins my enemies dey tok about mi.  
Dem dey ask, “Wen e go take die make pipol forget am?”   
6 Dem dey visit mi like sey dem bi my friends,  
but na wikedness full dia heart  
and wen dem komot from where I dey,  
dem go-go spoil mi give evribody.   
7 Pipol wey hate mi dey tok for each oda ear about mi  
and na only bad tins dem dey tink about mi.   
8 Dem sey, “E get some bad-bad diziz.  
E nor go ever get up from dat bed!”   
9 Even my best friend, di one wey I trust with evritin;  
pesin wey wi dey chop togeda, don turn against mi.   
10 So Oga God, make Yu sorry for mi.  
Make I well again, so dat I go pay dem back!   
11 Like dis, I know sey I dey make belle sweet Yu,  
bikos Yu neva let my enemies win mi.   
12 Instead, Yu don keep my life, bikos I dey innocent;  
Yu don let mi enter yor present forever.   
13 So make una praiz di Oga wey bi Israel God,  
bikos E dey alive forever and ever.   
Amen!