4
Prayer For Help For Evening 
 
For Di Kwayamasta: David Song 
 
1 My God, make Yu ansa mi wen I koll Yu.  
Na only Yu go fit diliver and free mi  
from wiked pipol and all my trobol.  
Make Yu sorry for mi kon hear my prayers.   
2 Na how long pipol go take dey tok bad about mi?  
How long una go dey tok wetin I nor do?  
How long una go kontinue to dey lie for my head?   
3 Make una know sey,  
God dey keep doz wey dey fear am for ensef  
and E go ansa wen wi koll am.   
4 So make yu fear God and nor sin.  
Make yu tink about am for nite kon turn from yor sins.   
5 Make yu offa sakrifice with di rite spirit give God  
kon trust am.   
6 Many pipol dey sey,  
“Who go fit show us wetin dey good?”  
So my God, make Yu smile for us.   
7 Yu don give mi more joy pass doz wey get many food  
and wine to drink.   
8 I dey sleep with peace,  
bikos na only Yu wey bi my God,  
dey save mi.