120
Prayer For Help 
 
David Song 
 
1 Wen I dey face trobol,  
I kry to God and E ansa my prayer.   
2 My God, make Yu save mi from pipol  
wey dey lie and deceive odas.   
3 Una wey sabi lie well-well, una know how God go take ponish una?  
Una know how una wahala go plenty rish?   
4 Dem go shuk una with sharp arrow  
kon burn una with hot shako from fire.   
5 I really sofa for Meshak town  
and e pain mi well-well sey I stay with Kedar pipol.   
6 I don taya to stay among pipol  
wey nor like peace.   
7 I dey look for peace;  
but wen ever I tok about am,  
na war dem dey give mi.