100
Praiz Song 
 
1 Make evritin wey dey dis eart,  
shaut with joy to God!   
2 Make una happy as una dey woship God.  
Make una sing with joy as una dey kom meet am.   
3 Make una know sey na di Oga God bi God!  
Na-im make us and wi bi en pipol.  
Wi bi en pipol, di sheep wey dey en field.   
4 So make una sing tanksgivin song as una dey enter en present!  
Make una enter en temple with tanksgivin.  
Make una tank and praiz en name.   
5 Bikos God dey good, en love wey nor dey fail dey forever  
and E dey good from one generashon go rish anoda.