4
Kohat Pipol Work
God tell Moses and Aaron: “Kohat pipol wey kom from Levi tribe, make dem kount dem akordin to dia family and towns. Make dem kount dem from thirty go rish fifty years and na all doz wey go fit work for di tent where dem for dey do meetin.
“Dis na di work wey Kohat pipol go do for di tent where dem for dey do meetin and koncerning di holy tins. Wen time don rish for di pipol to travel, Aaron and en sons must enter di tent kon take di curtain take kover di Kovenant Box. Den dem go use fine leda take kover am kon spread blue klot on-top. Den, dem must put di poles wey dem go take karry am for inside.
“Make dem use blue klot kover di tabol wey God bread dey, di plate, di incense bowl, di ofrin bowl and di jar wey dem dey use for wine ofrin. Bread must always dey di tabol. Dem must use red klot and fine leda take kover am, den put di poles wey dem go take karry am for inside.
“Di lampstand, di lamps, di fork, tray and all di olive oil kontaina wey dey der, dem go kover am with blue klot. 10 Make dem wrap am with di oda tools with fine leda kon put am for sometin wey dem go fit take karry am.
11 “Dem go spread blue klot for di altar wey dem make with gold kon kover am with fine leda and di poles wey dem go take karry am, go dey inside. 12 Dem go take all di tools wey dem dey use for di Holy Place, wrap dem with blue klot; use fine leda take kover dem kon put dem for sometin wey dem go fit take karry dem.
13 “Dem go still remove di ashes wey dey di altar kon kover am with purpol klot. 14 Den all di tools wey dem dey use take work for di altar, dem go put am on-top: di tray, di hook, shovel and basin. Den dem go kover am with fine leda kon put di poles wey dem go take karry am for inside. 15 Wen Aaron and en sons don kover di Holy Place and en tools finish; wen time don rish for di pipol to travel, Kohat pipol go karry doz tins; but dem nor go tosh anytin wey dey holy, bikos if dem tosh am, dem go die. Dis na Kohat pipol work for di tent.
16 “Di work wey dem give Aaron son, Eleazar, na di whole tent and di oil wey dey di lamps, di incense, di korn ofrin, di anointin oil and evry oda tin wey dey di tent wey dem don make holy for God.”
17 God tell Moses and Aaron, 18 “Make una nor allow God remove Kohat family from Levi tribe; 19 but dis na wetin una go do for dem, so dat dem nor go die wen dem go near di holy tins: Aaron and en sons go give each man en own work. 20 Kohat pipol nor go-go inside go look wen dem dey kover di holy tins, if not, dem go die.”
Gershon Pipol Work
21 God kon tell Moses: 22 “Gershon pipol wey kom from Levi tribe, make yu kount dem akordin to dia family and towns. 23 Make yu kount dem from thirty go rish fifty years and na all doz wey go fit work for di tent where dem for dey do meetin. 24 Gershon pipol work na to karry dis tins wey bi: 25 di tent, di kover for inside and outside, di fine leda kover on-top am, di curtain for di door-mot, 26 di curtains and di ropes for di kourt wey round di tent and di altar; di curtains wey dey di kourt door-mot and all di tins wey dem use take arrange dem. So na dem go do dis work. 27 Moses and Aaron go make sure sey Gershon pipol do all di work and karry evritin wey Aaron and en sons suppose use. 28 Dis na di work wey Gershon pipol go do for di tent; dem go karry am komot, just as Aaron pikin, Itama, kommand dem.”
Merari Pipol Work
29 God tell Moses, “Merari pipol wey kom from Levi tribe, make yu kount dem akordin to dia family and towns. 30 Make yu kount dem from thirty go rish fifty years and na all doz wey go fit work for di tent where dem for dey do meetin. 31 Dia work go bi to karry di frame, bar, post and base for di tent. 32 Di oda post, base, peg and ropes for di kourt wey round di tent, with all di tins wey dem take make dem. Each man go karry di tins wey dem sey make e karry. 33 Dis na di work wey Merari pipol go do for di tent: dem go karry dem komot, just as Aaron tell dem.”
Konklusion
34 So Moses, Aaron and di leaders kon kount Kohat pipol akordin to dia family and towns, 35 from thirty go rish fifty years wey go fit work for di tent where dem for dey do meetin. 36 Doz wey dem kount akordin to dia family na 2,750. 37 Dis na di ones wey Moses and Aaron kount for Kohat family, evribody go work for di tent where dem for dey do meetin, just as God kommand.
38 Doz wey dem kount for Gershon family, akordin to dia family and towns, 39 from thirty go rish fifty years wey go fit work for di tent where dem for dey do meetin. 40 Doz wey dem kount akordin to dia family and towns na 2,630. 41 Dis na di ones wey Moses and Aaron kount for Gershon family wey fit work for di tent where dem for dey do meetin, just as God kommand.
42 Doz wey dem kount for Merari family, akordin to dia family and towns, 43 from thirty go rish fifty years wey go fit work for di tent where dem for dey do meetin 44 na 3,200. 45 Dis na di ones wey Moses and Aaron kount for Merari family, just as God kommand.
46 All di pipol for Levi tribe, wey Moses, Aaron and di leaders kount akordin to dia family and towns, 47 from thirty go rish fifty years wey go fit work for di tent where dem for dey do meetin, 48 na 8,580.
49 Moses kount all dis pipol, just as God kommand am and each pesin get en work.