34
Di Land Borda For Sout
Den God tell Moses: “Make yu tell Israel pipol sey: ‘Wen una enter Kanaan land and evriwhere wey I promise to go give una; den di borda for sout go start from Zin Wildaness go rish di borda for Edom. Una sout borda go face east go rish di Salt Sea. Den e go turn from sout go Akrabbim kon kontinue go Zin till e rish Kadesh Barnea. E go-go nort-west to Hazar Addar and Azmon, where e go for turn face di valley wey dey Egypt borda and Mediterranean Sea.
Di Land Borda For West
“ ‘Di borda for west go bi di Mediterranean Sea.
Di Land Borda For Nort
“ ‘Dis go bi una borda for nort: Una go draw line from Mediterranean Sea go Mount Hor and from der, una go draw anoda line go Lebo-Hamat. E go kontinue from der go Zedad. Di borda go kontinue rish Zifron kon end for Hazar-Enan. Dis go bi una nort borda.
Di Land Borda For East
10 “ ‘For di borda for east: Una go draw line from Hazar-Enan go Shefam. 11 Di borda go from Shefam go Riblah for di east side for Ain and for Chinneret Sea. 12 Den e go-go Jordan River go rish di Salt Sea.’ Dis go bi di four borda for una land.” 13 So Moses tell Israel pipol, “Dis na di land wey una go get thru dice wey dem trow. God don give di land to di nine and half tribes. 14 Bikos Reuben, Gad and half for Manasseh tribe wey kom from east, don get dia propaty 15 for di east side for Jordan River near Jeriko.”
Moses Choose Ofisas
16 God tell Moses, 17 “Eleazar di priest and Joshua wey Nun born go divide di land for di pipol. 18 So make yu take one leader from each tribe, so dat dem go help divide am too. 19 Di men wey Moses pick from each tribe, na dia names bi dis: from Judah tribe, e pick Kaleb wey Jefunneh born; 20 from Simeon tribe, e pick Shemuel wey Ammihud born; 21 from Benjamin tribe, e pick Elidad wey Kislon born; 22 from Dan tribe, e pick Bukki wey Jogli born; 23 from Josef tribe, e pick Hanniel wey Efod born and na leader for Manasseh tribe; 24 from Efraim tribe, e pick Kemuel wey Shiftan born; 25 from Zebulun tribe, e pick Elizafan wey Parnak born; 26 from Issakar tribe, e pick Paltiel wey Azzan born; 27 from Asher tribe, e pick Ahihud wey Shelomi born; 28 from Naftali tribe, e pick Pedahel wey Ammihud born.” 29 Dis na di ones wey God kommand to divide di propaty among Israel pipol wey dey Kanaan land.