30
Wen Man Make Vow
All di leaders for di tribe, Moses kon tell dem about Israel pipol sey, “Dis na wetin God kommand: ‘If man make vow give God or take ensef take swear, e must nor break am, but e go do wetin e tok.
Wen Woman Make Vow
“ ‘If yong woman wey still dey stay en papa house make vow give God or promise with ensef and en papa hear en vow and e nor tok, den e must do evritin wey e vow or promise. But if en papa nor gri make e do wetin e vow wen e hear am, God go forgi-am, bikos en papa nor gri make e do am.
Wen Wife Make Vow
“ ‘If woman wey neva marry make vow, weda e know or e nor know, or promise and fail, den e kon marry, if di husband hear about en vow and e nor tok, den e must do evritin wey e vow or promise. But if di husband nor gri make e do wetin e vow, God go forgi-am.
Woman Wey En Husband Don Die Vow
“ ‘Woman wey en husband don die or dem nor dey togeda again, must do wetin e vow or promise.
10 “ ‘If woman wey don marry make vow or promise, 11 if di husband hear am and e nor tok, den e must do evritin wey e vow or promise. 12 But if en husband nor gri make e do wetin e vow or promise, e fit nor do am and God go forgi-am, bikos na en husband nor gri make e do am. 13 So en husband get di rite to gri or nor gri make e do wetin e vow or promise. 14 But if di day afta e hear about di vow, e nor tok anytin, e must do evritin wey e vow or promise and since e nor tok anytin for di day wen e hear about am, e don agri with di vow wey di woman make. 15 But if leta e nor gri make e do wetin e vow, e go sofa, bikos e nor allow am do wetin e vow.’ ”
16 Dis na di law wey God give Moses about vow wey koncern, man and en wife; and about papa and en dota wey dey di same house.