27
Special Law for Propaty
Den di dotas wey Zelofehad wey Hefa born, wey Gilead born, wey Makir born, wey Manasseh born wey Josef born kon kom. Di girls names na, Mahlah, Noah, Hoglah, Milka and Tirzah. Dem stand before Moses, Eleazar di priest, di leaders and all di pipol wey gada for di tent where dem for dey do meetin door-mot kon sey, “Awa papa die inside wildaness, aldo e nor join Korah pipol and doz wey gada demsef against God; but e die bikos of en own sin. Wetin go make awa papa name lost from en family, bikos e nor get man pikin? So make yu give us propaty from di ones wey awa papa family get.”
So Moses take dia kase go meet God. God tell Moses: “Zelofehad dotas ask for wetin dey rite. So yu must give dem dia papa propaty among dia family.
“Yu must tell Israel pipol sey, ‘If man die and e nor get man pikin, den una go give en propaty to en dotas; and if e nor get dotas, den una go give en propaty to en brodas; 10 but if e nor get brodas, den una go give en papa brodas en propaty; 11 if en papa nor get brodas, den una go give en propaty to di pesin wey dey klose to am pass for en family and e go take am. Dis go bi law wey Israel must obey, bikos na God kommand.’ ”
Joshua Bi Leader
12 Den God tell Moses, “Klimb go Abarim Mountin, so dat yu go si di land wey I don give Israel pipol. 13 Wen yu don si am, yu go die, just as yor broda Aaron take die. 14 Bikos for Zin Wildaness where di pipol for komplain against mi, yorsef komplain against my kommand wen yu suppose show how I dey holy, bikos of Meribah wota for Kadesh.”
15 Den Moses tell God: 16 “Oga God wey dey give life, make Yu choose one man wey go lead di pipol, 17 pesin wey go-go out before dem and kom back before dem and wey go lead dem, so dat God pipol nor go bi like sheep wey nor get who dey guide dem.”
18 God ansa, “Make yu take Joshua wey Nun born kon put yor hand for en head, bikos na-im go fit lead dem; 19 tell am make e stand before Eleazar di priest; before all di kommunity, den announce am as di pesin wey go take-ova from yu. 20 Give am some of yor pawa, so dat all di kommunity go obey am. 21 E go stand before Eleazar wey go-go hear from God akordin to di Urim. Akordin to en kommand, dem go-go out and kom in, both en and all Israel pipol.”
22 Moses do as God kommand am. E sey make Joshua stand before Eleazar di priest and di whole kommunity for Israel. 23 E put en hand for Joshua head kon sey na-im go take-ova from am. E do evritin, just as God kommand am.