10
Trumpet Sound
God tell Moses: “Make yu make two trumpet with silva from one hammer. Yu go use am take dey gada di kommunity and to tell dem wen dem won travel. Wen dem blow di two trumpet, all di kommunity must gada round yu for di tent where dem for dey do meetin door-mot. But if dem blow one, den di leaders and doz wey dey lead tazon go kom meet yu. Wen yu blow alarm, di pipol wey dey di east side must start to travel. Wen yu blow for di sekond time, di pipol wey dey di sout-side must start to travel. Yu must blow di trumpet wen yu gada di kommunity, but make yu nor sound alarm.
“Na only di priests wey bi Aaron shidren-shidren must blow di trumpet. Dis law na forever and una must obey am from one generashon go rish anoda. If una go fight against enemy wey dey attack una, den una must blow di alarm and di trumpet. Mi wey bi God go kon help and save una from una enemies. 10 And for di time wen una dey happy like di time for una festival or as di mont just dey start; una go blow di trumpet for una burnt ofrin and di sakrifice wey una dey do for peace ofrin, so dat God go dey remember una: Na mi bi di Oga una God.”
From Sinai To Kadesh
11 For di nomba twenty day, for di sekond mont, for di sekond year, afta di pipol don komot from Egypt, di kloud kon komot from di Tabanako for di Kovenant Box. 12 So Israel pipol start to travel from Sinai Wildaness. Di kloud kon kom down for Paran Wildaness.
Judah Tribe Start Di Travel
13 Dis na di first time wen dem start to travel akordin to di kommand wey God give Moses. 14 Just as dem take dey travel before, na so dem still dey do am. Judah tribe travel first akordin to dia family and na Nahshon wey Amminadab born dey lead dem. 15 Netanel wey Zuar born, na-im dey lead Issakar tribe. 16 Na Eliab wey bi Helon pikin dey lead Zebulun pipol. 17 Den dem karry di Tabanako go down and Gershon and Merari shidren kon karry di Tabanako as dem kontinue dia journey.
Dem Arrange Di Tribe
18 Di next tribe wey follow na Reuben pipol and dem kon dey waka with dia flag. Na Elizur wey Shedeur born dey lead dem. 19 Shelumiel wey Zurishaddai born, na-im dey lead Simeon pipol. 20 Den Eliasaf wey bi Deuel pikin kon dey lead Gad pipol. 21 Kohat pipol waka go karry di tins for di sanctuary and before dem go rish der, dem must don karry di Tabanako up.
22 Di next tribe na Efraim pipol wey dey waka with dia flag, akordin to dia family and na Elishama wey Ammihud born dey lead dem. 23 Gamaliel wey Pedahzur bi en papa, na-im dey lead Manasseh tribe 24 and Abidan wey Gideoni born dey lead Benjamin tribe.
25 Doz wey dey Dan tribe dey waka with dia flag, na dem bi di rear guide wey dey work for all di kamp akordin to dia family; Na Ahiezer wey Ammishaddai born dey lead dem. 26 Pagiel wey Okran born, na-im dey lead Asher pipol 27 and Ahira wey en papa bi Enan dey lead Naftali tribe. 28 Dis na di way Israel pipol take travel; family by family.
Moses Wife Broda
29 Moses tell en wife broda Hobab wey en papa na Reuel wey kom from Midian sey, “Wi won start to travel go di place wey God don sey E go give us. E don promise to make Israel prosper, so make yu follow us and wi go trit yu well.”
30 But Hobab ansa, “I nor go follow una, instead I go-go my own land go meet my pipol.”
31 Moses kon sey, “Make yu nor leave us, bikos na Yu know where wi go stay for inside di wildaness and na yu go bi awa eye. 32 If yu follow us, wi go share all di blessings wey God go give us, with yu.”
33 Wen di pipol don komot from Sinai, wey bi di holy mountin, dem kon travel for three days. God Kovenant Box dey with dem for dat three days wey dem travel so and dem kon dey find where dem go fit rest put small. 34 As dem dey travel, God kloud dey kover dem.
35 And wen dem karry di box dey travel, Moses go sey,
“My God! Arise
make yor enemies dem skata
and make all doz wey hate Yu,
run as dem si Yu dey kom.”
36 And wen di box stop, Moses go sey,
“My God! Make Yu kom back
kom meet Israel, yor pipol wey plenty.”