3
Pipol Wey Build
Eliashib wey bi di high priest and en oda priests build di Sheep Gate, dedikate kon put di doors as dem suppose dey. Dem build go rish di Hundred Towa and Hananel Towa kon dedikate dem too. Jeriko men build di next part. And Zakkur wey bi Imri pikin build di next one.
Hassenaah sons build di Fish Gate, dem fix di doors, en bolts and bars. Meremot wey Hakkoz pikin Uriaya born, ripair di next part. While Meshullam wey Meshezabel pikin Berekaya born, do di next part. Na Zadok, wey Baanah born, ripair di oda part. Tekoa men do di next part wey dem give dem, but some among di leaders for di town nor gri do di work wey dia oga give dem to do.
Joiada wey bi Paseah pikin with Meshullam wey Besodeaya born kon ripair Jeshanah Gate. Dem fix di doors, en bolts and bars. Melataya wey kom from Gibeon, Jadon wey kom from Meronot, Gibeon men and Mizpa kon ripair di next part go rish West Eufrates govnor side. Uzziel wey bi Harhaya pikin, wey dey melt gold kon ripair di next part. Hananaya wey dey make perfume, ripair di next side go rish di Broad Wall. Refaaya wey Hur born, wey dey rule half of Jerusalem aria kon ripair di next part. 10 Na Jedaya wey bi Harumaf pikin, ripair di side wey dey near en own house. Hattush wey Hashabneaya born, ripair di next side. 11 Malkijah wey Harim bi en papa with Hasshub wey bi Pahat-Moab pikin kon ripair di next part and Ovens Towa. 12 Shallum wey Hallohesh born, wey bi ruler for di oda half of Jerusalem aria, ripair di next part and en dotas help am for di work.
13 Hanun and di pipol wey dey stay Zanoah aria, ripair di Valley Gate. Dem ribuild am kon fix di doors, en bolts and bars. Dem still ripair di wall wey bi 1,500 fit wey lead to di Dirty Gate.
14 Na Malkijah wey bi Rekab pikin, wey bi ruler for Bet-Hakkerem aria, ripair di Dirty Gate. E ribuild am kon fix di doors, en bolts and bars.
15 Shallum pikin, Kol-Hozeh, wey bi ruler for Mizpa aria, ripair di Well Gate. E ribuild and roof am, kon fix di doors, en bolts and bars. For Siloam Pool, near di royal gardin, e still ripair di wall go rish di road wey lead to David Town. 16 Nehemaya wey bi Azbuk pikin, wey dey rule half of Bet-Zur aria, ripair di next side go rish David Grave, with di pool and di Sojas House.
17 Levi pipol wey ripair di next parts na, Rehum wey bi Bani pikin, while Hashabaya wey dey rule half of Keilah aria, ripair di next part for en aria pipol. 18 Na Binnui wey bi Henadad pikin, wey dey rule di oda half of Keilah aria, ripair di next part. 19 Ezer wey bi Jeshua pikin, wey bi ruler for Mizpa, ripair di next part for armoury front, go rish di place where di wall for turn. 20 Baruk wey Zabbai born, ripair di next part go rish where dem dey pass enter Eliashib di high priest house. 21 Meremot wey Hakkoz pikin Uriaya born, ripair di next part go rish di end for Eliashib house.
22 Na all di priests from di aria wey dey near der, ripair di rest part for di wall. 23 Benjamin and Hasshub, ripair di next part wey dey front of dia house. Zabud wey Ananaya pikin Maaseaya born, ripair di next part wey dey en house front. 24 Na Binnui wey bi Henadad pikin ripair di next part, from Zabud house go rish di wall korna. 25 Na Palal wey bi Uzai pikin, ripair di next part from di wall korna and di towa for di king uppa house wey near di guards kourt. Afta am, na Pedaaya wey bi Parosh pikin 26 and di temple savants wey dey stay Ofel Hill ripair rish di aria wey dey opposite di Wota Gate for di east side and di towa wey dey guide di temple. 27 Afta dem, Tekoa men ripair anoda part wey dey opposite di big towa, wey guide di temple go rish Ofel wall.
28 Some priests ripair from top of di Horse Gate and each pesin ripair front of en own house. 29 Zadok wey bi Imma pikin, ripair di next part, wey dey front of en house. Shemaya wey Shekanaya born, wey dey guide di East Gate, ripair di next part. 30 Hananaya wey bi Shelemaya pikin with Hanun wey bi Zalaf sixt pikin, ripair di oda part. Afta dem, Meshullam wey bi Berekaya pikin kon ripair di oda side for en house front. 31 Malkijah wey dey melt gold, ripair di next side go rish di temple savants and di tradas house, wey dey near Inspeshon Gate go rish di uppa room for di korna side. 32 Odas wey dey melt gold and di tradas, ripair di last part from di uppa room wey dey korna, go rish di Sheep Gate.