7
Di Farisee Tradishon
Di Farisee pipol and some law tishas, wey kom from Jerusalem gada for where Jesus dey. Dem kon si sey Jesus disciples dey chop bread wen dem neva wosh dia hand. (Bikos di Farisee and Jew pipol, nor dey chop unless dem wosh dia hand akordin to dia tradishon. And wen dem kom back from market, dem nor dey chop unless dem first wosh dia hand. Dem still dey follow many oda tradishons, like to wosh cup, kettol and chair wey dem dey sidan put chop.)
Di Farisee pipol and di law tishas kon ask Jesus, “Why yor disciples nor dey do akordin to awa tradishon, but instead dem dey chop with dirty hand?”
Jesus ansa dem, “Di tin wey Profet Isaya profesai about una, na true, bikos una dey pritend, as dem rite for God word,
“ ‘Dis pipol dey praiz Mi with dia mout,
but dia heart dey far from Mi.
Dem dey woship Mi for nor-tin,
dey tish sey make pipol obey human being law.
Dem nor dey respet God law, but dem dey obey human being law.’ ”
Jesus still tell dem, “Una rijet God kommandment, so dat una go fit keep una own. 10 Bikos Moses sey, ‘Make yu respet yor papa and mama’ and ‘Anybody wey curse en papa or mama, dem must kill-am.’ 11 But una sey e dey okay for pesin to tell en papa and mama sey, ‘Make yu nor vex, I nor fit help yu, bikos di money wey I suppose give yu, I don gi-am to God.’ 12 So, like dis, una nor go let di pesin do good for en mama or papa. 13 Na so una dey use una tradishon wey una dey tish pipol take dey spoil God word. And una still dey do many tins like dis.”
14 Den Jesus koll di pipol again sey, “Evribody, listin to mi make una for undastand wetin I dey tok. 15 Nor bi wetin enter inside pesin body go make am dirty for God eye, instead na wetin kom out from en mout, dey make am dirty. 16 Anybody wey get ear, make e hear wetin I dey tok.”
17 Wen Jesus leave di pipol enter house, en disciples kon ask am about di parabol. 18 E kon tell dem, “Na so una fool rish? Una nor know sey anytin wey from outside enter pesin belle nor go fit make am dirty for God eye? 19 Bikos nor bi di pesin heart e dey enter, na en belle and e go shit am komot. (Dis one mean sey all food dey klean.)”
20 Jesus kon sey, “Wetin kom out from pesin heart, naim dey make am dirty. 21 Bikos to sleep with who yu nor marry, to tif, to kill pesin, 22 to sleep with anoda pesin husband or wife, long-trot, evil tins, to deceive pesin, to dey misbihave, jealousy, to spoil anoda pesin, to karry body up and to do foolish tins, na from inside pesin heart all dis bad-bad tins dey from kom. 23 All dis evil tins dey kom from inside pesin and na dem dey make pesin dirty for God eye.”
One Woman Faith
24 Afta Jesus komot from der, e kon go di aria wey dem dey koll Tyre. Wen e enter one house, e nor wont make anybody know sey e dey der, but e nor fit hide. 25 One woman wey evil spirit dey worry en dota kon hear about Jesus and e kom meet am kon fall for en front. 26 Di woman na Greek wey kom from Sirofoenicia. E kon beg Jesus make e drive di demon komot from en pikin body.
27 But Jesus tell am, “Make di shidren chop beleful first, bikos e nor good to take shidren food give dog.”
28 Di woman ansa, “Yes, Oga God, but even dogs dey chop di small-small food wey dey fall from shidren plate.”
29 Jesus kon tell am, “Since yor faith strong rish to tok like dis, make yu dey go. Di demon don komot from yor pikin body.”
30 Wen di woman rish house, e kon si en pikin sleep for bed and di demon don leave am.
Jesus Heal Deaf And Dumb Pesin
31 Den Jesus komot from Tyre kon pass Sidon go Galilee Sea for Dekapolis aria. 32 Some pipol karry one man wey nor dey hear or tok kom meet am sey make e tosh di man with en hand.
33 Wen Jesus don take di man go korna for where pipol nor dey, e kon put en two fingers inside di man ear, e spit for en hand kon tosh di man tongue. 34 Den e look heaven kon sey, “Efratah!” (wey mean, “Make yu open”). 35 At wons, di man ear open, en tongue luz and e kon start to tok.
36 Jesus kon sey make dem nor tell anybody wetin happen. But dem kon dey tok am for evriwhere. 37 Pipol sopraiz well-well dey sey, “Jesus don do evritin well. E even make di pipol wey nor dey hear, hear and pipol wey nor fit tok, e don make dem dey tok.”