15
Jesus And Pilate
For early morning afta dem don plan wetin dem go do Jesus, di priest oga dem with di law tishas and di Sanhedrin, tie am kon take am go meet Pilate.
So Pilate ask Jesus, “Na yu bi di Jew pipol king?”
Jesus ansa, “Na as yu tok.”
Den di priest oga dem still dey akuiz am, so Pilate ask Jesus again, “Yu nor get anytin to tok? Yu dey hear all dis tins wey dem sey yu do?”
But Jesus nor tok anytin and dis tin kon sopraiz Pilate well-well.
Jesus and Barabas
Anytime wen dem dey do di Passova Feast, Pilate always dey free one prisona wey di pipol ask for. Barabas, one man wey kill pesin for di time wey dem dey rayot, dey prison with pipol wey nor dey obey govment law. Den di pipol kom meet Pilate kon ask am sey, make e free one prisona for dem, as e dey do before.
So Pilate ask dem, “Una wont make I free Jew pipol king for una?” 10 (Pilate know sey di priest oga dem bring Jesus to am, bikos dem dey jealous). 11 But di priest oga dem tell di pipol make dem ask Pilate make e free Barabas.
12 So Pilate ask dem again, “Den wetin una wont make I do to dis man wey una koll Jew pipol king?”
13 Dem kon shaut, “Kill-am trowey!”
14 Pilate ask dem, “Why? Wish bad tin e do?”
But dem kon dey shaut more-more, “Kill-am trowey!”
15 Bikos Pilate one do wetin di pipol wont, e kon free Barabas for dem, den afta e tell en sojas make dem flog Jesus, e kon give Jesus to di pipol make dem go kill-am.
Sojas Laf Jesus
16 So di sojas push Jesus enter di varanda for di govnor palis kon koll evribody gada. 17 Dem wear am purpol klot kon take shuku-shuku make crown wear for en head. 18 Dem kon dey salot am, “Wi hail yu o-o, Jew pipol king!” 19 Dem take stik nak am for head kon spit for en body. Dem knee down for en front dey bow for am. 20 Wen dem don laf am finish, dem pul di purpol klot komot from en body kon wear am en own klot. Den, dem kon go kill-am.
Dem Nail Jesus For Cross
21 Di sojas kon force Simon, one man from Sirene, wey just dey enter di town, make e karry Jesus cross. (Di man na Alexanda and Rufus papa.) 22 Dem take Jesus go di place wey dem dey koll Golgota (wey mean, “Skull Place”). 23 Dem gi-am wine wey dem mix with myrrh, but Jesus nor gri drink am. 24 Dem nail am for cross kon divide en klot, dey trow dice make dem for know wetin go rish each pesin.
25 Na nine oklok for morning dem take nail Jesus for cross. 26 Dem kon rite sey, “Dis na Jew pipol king.” 27 Dem nail two tif with am for cross, one for en left and di oda for en rite side. 28 Wetin dem rite for God word kon happen sey, “Dem kount Jesus join bad pipol.” 29 Pipol wey dey waka pass kon dey shake dia head and dey tok bad about am sey, “Eehen! Yu wey sey, yu go fit distroy di temple kon build am again for three days. 30 Oya! Save yorsef make yu kom down from di cross!”
31 Even di priest oga dem and di law tishas dey laf Jesus for where dem sidan, dey sey, “E save oda pipol, but e nor fit save ensef! 32 Christ, wey sey e bi Israel king, make e kom down from di cross naw make wi si am, so dat wi go bilive!” Doz wey dem nail for cross with am kon dey curse am too.
Jesus Die
33 Wen twelf oklok for aftanoon rish, darkness kon kover di kountry until three oklok for aftanoon. 34 Around three oklok, Jesus kon shaut sey, “Eloi! Eloi! Lama Sabaktani?” Wey mean, “My God! My God! Wetin make yu abandon mi?”
35 Wen some pipol wey stand near der hear wetin e tok, dem kon sey, “Listin. E dey koll Elijah!”
36 Den one pesin run kom with foam kon soak am inside betta wine, den e put am for stik give Jesus make e drink, den e kon sey, “Make una leave am! Make wi si weda Elijah go kom save am.”
37 But Jesus shaut again, den e kon die.
38 So di curtain for di temple tear into two from top go rish bottom. 39 Wen di soja wey stand for Jesus front si how e take die, e kon sey, “True-true dis man na God Pikin!”
40 Some wimen dey der dey look from far. Dem bi Mary Magdalin, Mary wey bi Josef, James and Salome mama. 41 For di time wen Jesus dey Galilee, dis wimen dey follow and help am. Many oda wimen wey follow am kom from Jerusalem, dey der too.
Jesus Burial
42 Wen evening don rish for di day before di Sabat Day, 43 Josef wey kom from Arimatea, wey bi Jew kansol memba, wey dey wait for God Kingdom and pipol dey respet am well-well, go meet Pilate kon ask for Jesus body. 44 Pilate sopraiz sey Jesus don die. So e koll di soja kon ask am weda e don tey wen Jesus die. 45 Wen Pilate hear wetin di soja tok, e kon sey make Josef go karry di body. 46 Josef buy linen klot, bring Jesus body kom down from di cross kon take di klot wrap am, den e put am for grave wey dem dig inside rock. Den e roll big stone kover di grave mout. 47 Mary Magdalin and Mary wey bi Josef mama dey look and dem si where dem beri Jesus put.