12
Tenants Parabol
Jesus kon tok to dem with parabol: “One man plant grape for en farm. E fence am round, dig where dem go dey press di wine put, den kon build big house wey guide go dey stay. E hire am give tenants wey go dey kare for di farm kon travel go far. Wen harvest time rish, e send one of en savant go meet di tenants make dem gi-am en own share for di harvest. But di tenants seize di savant, beat am kon send am go back with empty hand. Di man still send anoda savant go meet dem. Dem nak en head kon beat am anyhow. E send anoda one again, dem kon kill-am. Na so dem beat and kill oda savants wey e send too.
“Di man get one pikin wey e love well-well and na dis one remain for am to send. At last, e kon send am go meet dem dey tok for en mind sey, ‘As dis one bi my pikin, dem go respet am.’
“But wen di tenants si am dey kom, dem kon sey, ‘Na di owner pikin dey kom so. Make wi kill-am, so dat wi go get all di propaty for awasef.’ So dem seize am, kill-am kon trow en body outside di farm.
“Na wetin una tink sey di farm owner go do? E go distroy doz tenant kon give di farm to oda pipol. 10 Una neva read God word wey sey,
“ ‘Di stone wey di builders rijet,
don turn to di main stone?
11 Dis na wetin God do
and e good for awa eye well-well.’ ”
12 Naw, dem won kon arrest am, but dem dey fear di pipol, bikos dem know sey Jesus tok dis parabol against dem. So dem kon waka leave am.
Kweshon About Tax
13 Dem send some Farisee and Herod pipol, make dem find way to katch Jesus with wetin e go tok. 14 Wen dem meet am, dem kon ask am, “Tisha, wi know sey yu dey tok trut, yu nor dey do wayo and yu dey tish di trut about God way. E good make wi dey pay tax give Caesar, abi make wi nor pay?”
15 But Jesus know dia wayo, so e tell dem, “Why una dey test mi? Make una bring one koin make I si.” 16 So dem bring one koin and Jesus ask dem, “Wish pesin face and name dey di money so?”
Dem ansa, “Na Caesar own.”
17 Jesus tell dem, “Make una give Caesar di tins wey bi Caesar own and make una give God di tins wey bi God own.” Dem sopraiz well-well for wetin Jesus tok.
Marriage and Resureshon
18 Di Sadusi pipol (wey nor bilive sey pipol go wake-up from deat) kom meet Jesus tell am, 19 “Tisha, Moses rite give us sey: ‘If man broda die and en wife nor born for am, en broda must marry di woman, make dem for born shidren for di broda wey don die.’ 20 E get seven brodas. Di first one marry and wen e die, e nor get shidren. 21 Di sekond one kon marry di woman and e nor still get pikin before e die and na so e happen for di third one. 22 No one for di seven brodas wey marry di woman get pikin. At last, di woman too kon die. 23 For di time wey pipol go wake-up from deat, na wish pesin wife di woman go kon bi, as e bi sey all di seven brodas marry am?”
24 Jesus ansa dem, “Una nor know sey una dey deceive unasef, bikos una nor know God word and en pawa. 25 Wen pipol wake-up from deat, dem nor go marry again, instead dem go bi like angels for heaven. 26 Naw, for di matter about pipol wey go wake-up, una neva read for di book wey Moses rite about di bush wey fire dey burn and how God tell Moses, ‘Na Mi bi Abraham, Isaak and Jakob God?’ 27 God nor bi God for di pipol wey don die, but na for di pipol wey dey alive. Na big mistake una dey make so!”
Kommandment Wey Big Pass
28 So, one man wey sabi di law kon dey hear dem dey argue. Wen e si sey Jesus dey ansa dem well, e kon ask am, “Wish kommandment big pass?”
29 Jesus ansa am, “Na dis bi di kommandment wey big pass: ‘Make una listin, Israel pipol, di Oga God, awa God na one e bi. 30 Make una love God una Oga God with all una heart, soul and all una pawa.’ 31 Di sekond one na, ‘Make una love una neighbour as una love unasef.’ E nor get any kommandment wey big pass dis two.”
32 Di man wey dey tish di law kon tell Jesus, “Na thru, Tisha. Yu dey korrect for wetin yu tok, na only God bi Oga God and know oda god dey apart from am. 33 To love God with all awa heart, mind and pawa and to love awa neighbour as awasef big pass all di sakrifice and ofrins wey pesin fit give God.”
34 Wen Jesus si sey di man tink well before e ansa, e kon tell di man, “Yu nor dey far from God Kingdom.” From dat time, nobody get di mind to ask am any kweshon again.
Di Mezaya: Na Wish Pesin Pikin E Bi?
35 As Jesus dey tish for di temple varanda, e kon sey, “Why e bi sey di law tishas dey sey Christ na David pikin? 36 Di Holy Spirit pawa make David tok sey,
“ ‘God tell my Oga God,
sidan for my rite hand
until I go put yor enemies
under yor leg.’
37 If David ensef koll Christ, ‘Oga God,’ how Christ go kon take bi en pikin again?”
Di pipol wey gada kon dey listin to am with happiness.
Warnin About Pipol Wey Sabi Di Law
38 Wen Jesus dey tish, e kon sey, “Make una dey kareful about di pipol wey sabi di law. Dem like to waka about with long klot and dem like loud greetin for market, 39 di chair wey betta pass for sinagog and high tabol for party, na der dem dey like sidan put. 40 Woman wey en husband don die, dem dey kollect en propaty and dem dey pray long prayer make pipol for si dem. Na dia ponishment go worse pass.”
Widow Ofrin
41 Den, Jesus sidan face di ofrin box, dey look as pipol dey put money inside. Many rish pipol kon dey put plenty money inside. 42 One poor woman wey e husband don die kon kom, put two koins wey nor rish one penny for inside di box.
43 Jesus kon koll en disciples sey, “I tell una true word, dis poor woman wey e husband don die put money wey pass di oda pipol own. 44 Bikos di oda pipol give dia ofrin from di plenty money wey dem get, but dis woman, as e poor rish, put evritin wey e get for life.”