7
Israel Sin 
 
1 E don finish for mi!  
I bi like pesin wey nor si fruit chop  
or si fruit pick afta dem don harvest evritin.   
2 Betta pipol wey dey fear God,  
don die komot di eart  
and e nor get anybody  
wey dey good and honest for dis eart again.  
Evribody for di eart dey wait to kill each oda;  
dem dey set trap dey wait dia brodas for road.   
3 Dia hand dey only like to do bad tins!  
Doz wey bi ofisas and judge,  
na only bribe dem wont.  
Doz wey get pawa,  
dey use am get wetin dem wont.   
4 Even di pesin wey good pass among dem,  
bi like shuku-shuku;  
di one wey dey fear God pass among dem,  
wiked pass many shuku-shuku wey dem tie togeda.  
But di day wen God go judge dem, dey kom;  
di time wey E go ponish dem for evritin.   
5 So make una nor trust anybody;  
even if di pesin na una best friend or wife!   
6 Bikos boy pikin go rijet en papa  
and na so too girl pikin go rijet en mama.  
Wife go sey e nor know en husband mama  
and una enemy, go bi una family memba!   
7 But as for mi, I bilive sey God go kom help mi.  
I dey wait for God with all my heart,  
so dat E go save mi.  
Yes! My God go hear mi.   
8 So my enemies, make una nor happy,  
bikos of mi!  
Bikos wen ever I fall, I go raiz-up again.  
Even doh I dey for darkness,  
Oga God go bi my lite.   
9 I go dey patient as God dey ponish mi,  
bikos I don sin against am.  
But afta E don ponish mi,  
E go fight for mi kon make mi win.  
God go take mi enter di lite  
and I go si en raitiousness.   
10 Den my enemies go si sey God dey for my side  
and shame go katch dem.  
Dis na di same enemies wey ask sey,  
“Where dat yor Oga God dey?”  
And naw, I go si as dem dey fall  
and I go mash dem pass  
like portor-portor for road.   
11 For dat day, dem go ribuild Israel town  
and dia land go wide well-well.   
12 Pipol go from difren land kom honor una;  
dem go kom from Assyria go rish Egypt town;  
from Egypt to Eufrates River  
and from di far sea go di mountins.   
13 But di land go still dey empty and dirty go full am,  
bikos of di wiked tins wey doz  
wey dey stay der before, don do.   
God Sorry For Israel 
 
14 Naw, my God, make Yu protet yor pipol  
with yor shepad stik.  
Make Yu lead yor pipol  
wey dey special for yor eye.  
Even doh dem dey stay alone for bush,  
make yu let dem chop betta food  
wey dey Bashan and Gilead,  
just as dem dey do before.   
15 God sey,  
“Yes! I go do big mirakle among una;  
di kind ones wey I do wen I save una from Egypt  
where una for bi slaves.”   
16 All di nashons for di world go stand sopraiz  
for wetin God go do for una.  
God mighty pawa go make dem konfuse.  
Dem go sopraiz kon kwayet  
dey look evritin wey dey happen.   
17 Just as snake dey creep kom out from whole,  
na so too dem go fear kon turn  
kom meet di Oga awa God.   
18 E nor get anoda god like Yu;  
Yu dey forgive yor pipol wey survive.  
Yu nor dey vex forever, instead, Yu dey happy  
to show yor pipol yor love wey nor dey end.   
19 Yes! Yu go sorry for yor pipol.  
Awa sins go dey under yor leg  
and Yu go trow dem go under di sea!   
20 Just as Yu promise awa grand-grand papa,  
Abraham and Jakob,  
na so too Yu go show us yor faithfulnes  
and love wey nor dey fail.