4
Oga God Mountin
For di last days, di mountin where God temple dey, na-im go high pass all di mountins. E go high pass di hills too and pipol from evry nashon go dey rush go der go woship God. Pipol from many nashons go kom and dem go sey,
“Make una kom
make wi go di Oga mountin
wey bi Jakob God house,
so dat E go tish us en laws
and wi go do evritin just as E wont am.”
Nor bi only di pipol for Zion and Jerusalem go hear God word,
but oda nashons go hear am too.
God go judge many pipol
kon setol di kworel wey strong nashons get.
Den dem go dey use dia swod and spears
take dey work for farm.
Pipol from difren kountry nor go fight each oda again
or train dia pipol to go fight war.
Evribody go stay for peace and dem go prosper.
Dem go enjoy dia own grape and fig tree,
bikos e nor get anytin wey go make dem fear.
God wey dey mighty don promise!
Even doh di nashons around us dey serve dia juju,
wi go woship and obey di Oga awa God
forever and ever.
Israel Pipol Go Kom Back
God sey,
“Di time dey kom wen I go gada doz wey nor fit waka;
wey bi slave for anoda kountry
and doz wey nor happy at-all.
Doz wey dey weak, go survive
and doz wey bi slave and prisonas for anoda kountry,
go kon bi one strong nashon.
Den mi wey bi God go rule Jerusalem
as dia king forever.”
But Jerusalem; di place
where nor-tin bad go happen to God pipol,
yor royal strent and pawa go kom back again.
Di king go get pawa for Jerusalem again.
But naw, wetin make una dey shaut and kry?
Una nor get king to lead una?
Abi dem don kill una wise men finish?
So wetin make una dey feel pain
like woman wey won born?
10 Jerusalem pipol, make una shaut and kry
like woman wey won born,
bikos dem must karry una go Babilon as slave.
But God go save una for der;
E go save una from una enemies hand.
11 Naw, many nashons don gada against una
kon sey, “Make dem skata di town!
Make wi look as dem dey distroy Jerusalem.”
12 But dem nor know wetin God dey tink;
dem nor undastand en plans.
Dis pipol nor know sey God dey gada dem,
so dat dem go beat and mash dem
pass like korn wey dem mash for groun.
13 God sey, “Jerusalem!
Make yu raiz-up kon skata di nashons,
bikos I go give yu iron and bronze horn,
so dat yu go fit distroy many nashons!
Yu go give di propaty and di money wey dem tif
to Oga God wey dey rule di eart.”