6
Solomon Build Di Temple
Afta 408 years wen Israel pipol don komot from Egypt, wey bi di fourt year wen Solomon don dey rule Israel, for di sekond mont wey bi Ziv mont, Solomon kon start to build di temple.
Di temple long rish 90 fit kon wide rish 30 fit and e high rish 45 fit. Di passage wey dem take dey enter di temple wide rish 30 fit and na so e long too. E still use 15 fit take long go outside. Solomon still use frames make windows for di temple. E build some room take join di temple walls for outside. Di rooms for outside na three story building and di bottom floor wide rish seven and half fit, di middle floor na 9 fit while di top floor na ten and half fit. E build di room join di temple but dia timba nor enter di wall.
Dem make di stones wey dem take build di temple, from where dem for kut dem, so no hammer, axe or any oda iron make sound for di main site. Where dem dey pass enter di down floor dey di sout-side for di temple and dem put step to take klimb go di sekond and di third floor. So Solomon kon build di temple finish. E put ceiling wey dem make with woods and cedar boards. 10 E build difren rooms round di temple; dem high rish seven and half fit and e use timba join dem to di temple. 11 God tell Solomon, 12 “But for dis temple wey yu dey build, If yu obey all my laws and kommand, evritin wey I promise yor papa David, I go do dem for yu. 13 I go stay with my pipol Israel and I nor go ever abandon dem.”
14 So, Solomon kon build di temple finish. 15 From di groun go rish di ceiling for inside, na cedar wood dem take kover dem kon make di floor with pine wood. 16 Di room for inside wey dem dey koll, “Most Holy Place” na di temple back dem build am put. E long rish 30 fit and dem use cedar board take divide am from groun go rish di ceiling. 17 Di room wey dey front for di “Most Holy Place”, long rish 60 fit. 18 Dem dekorate di cedar panels with tins wey den karve and with flowers, den dem use cedar wood kover di inside, so dat dem nor go si di stones wey dey di wall.
19 Dem build di inside room for di temple back and dem won put God Kovenant Box for der. 20 As di inside room long, na so too e high rish 30 fit and dem kover evriwhere with gold. Dem kover di temple with cedar panels. 21 Dem kover di temple for inside with gold kon use gold shain cross and kover where dem dey pass enter. 22 Dem kover evriwhere for inside di temple with gold, plus di altar wey dey di “Most Holy Place.”
23 Dem make two creatures wey get feadas with olive wood and di creatures dey di, “Most Holy Place.” Each of di creature, tall rish fifteen fit. 24 Each of di first creature feada long rish seven and half fit, so di two feada na 15 fit. 25 Di sekond creature bi like di first one but for size and shape; 26 each of dem tall rish 15 fit. 27 Dem put dem for di two side for di “Most Holy Place.” So dia feadas wey dem spread, go tosh each oda for di room middle and di oda two feadas tosh di wall. 28 Na gold dem use take make di two creatures.
29 Dem use creatures wey dem karve with feadas, palm tree and flower, take dekorate di wall both for inside and outside. 30 Dem even use gold take dekorate di floor.
31 Na olive wood dem take make doors wey pipol go pass enter and di pila for each door, get five side. 32 Di two doors wey dem make with olive wood, dem karve doz creatures with feadas, palm tree and flower put kon kover dem with gold. 33 Like dis, dem make door-mot with olive wood for di place wey dem dey pass enter di main hall and dem get four pila for di side. 34 Dem still make two doors with pine wood and each door get two side wey dey fold. 35 Dem karve creatures with feadas, palm tree and flower take dekorate am kon kover all of dem with gold.
36 Dem build one kourt for di temple front kon use cedar wood and stones take make di wall.
37 For Ziv mont, for di fourt year wey Solomon don dey rule, naim dem lay di foundashon for God Temple. 38 For Bul mont (wey bi di eight mont) for di elevent year, dem komplete di temple just as dem plan sey e go bi. Na seven years Solomon take build di temple finish.