4
Solomon Ofisas
King Solomon rule evriwhere for Israel land. Dis na en ofisas:
Azaraya wey bi priest and na Zadok bi en papa.
Elihoref and Ahijah wey bi Shisha shidren na dem bi seketry for di kourt.
Jehoshafat wey bi Ahilud pikin, na en dey keep rekord.
Na Jehoiada pikin, Benaya bi di sojas oga.
Na Zadok and Abiatar bi priest.
Na Natan pikin, Zabud bi shief to di difren govnor.
Ahishar dey kare for di palis savants,
while Adoniram wey Abda born, dey kare for doz wey dey do hard work.
Solomon put twelf men as govnor for Israel. Na dem dey provide food for di king, en family and di difren aria. Each of di twelf men dey handle each mont for di year. Dis na di ofisas and di district wey dem dey kare for:
Ben Hur dey kare for Efraim hill kountries;
Ben-Deka dey kare for Makas, Shaalbim, Bet-Shemesh, Elon and Bet-Hanan town.
10 Ben-Hesed dey kare for Arubbot, Soko and all di aria for Hefa.
11 Ben-Abinadab wey marry Solomon dota Tafat, dey kare for all di aria for Dor.
12 Baana wey Ahilud born, dey kare for Taanak, Megiddo and all di aria for Bet-Shean near Zaretan town, for di sout-side for Jezrel town go rish Abel-Meholah and Jokmeam town.
13 Ben-Geber dey kare for Ramot town for Ramot Gilead and all di village for Ramot wey Jair town get and na Manasseh grand-grand pikin e bi. E still dey kare for all di aria for Argob for Bashan wey bi sixty big towns wey dem fence round and e get bronze bars.
14 Ahinadab wey bi Iddo pikin dey kare for Mahanaim aria.
15 Ahimaaz wey still marry Basemat wey bi King Solomon dota, dey kare for Naftali aria.
16 Baana wey bi Hushai pikin dey kare for Asher aria and Bealot town.
17 Jehoshafat wey bi Paruah pikin, dey kare for Issakar aria.
18 Ela pikin wey bi Shimei dey kare for Benjamin aria.
19 Gibeah wey Uri born, naim dey kare for Gilead wey King Sihon from Amor and King Og for Bashan bin dey rule. Apart from dis twelf, e still get one govnor wey dey rule di whole land.
Solomon Reign
20 Israel and Judah pipol plenty like san-san for wotaside; dem get enough food to chop and drink and dem dey happy. 21 Na Solomon dey kontrol all di nashons from Eufrates River go rish Filistia and Egypt borda. Dem dey under am dey pay tax gi-am till e die.
22 Di tins wey Solomon nid evriday, na 150 bag of fine flower and three hundred bag of food, 23 den 10 big melu, 20,000 fat melu and 100 sheep with deer, gazelle and bird wey dem feed well. 24 Solomon rule di west and evriwhere for Eufrates River. From Tifsah for Eufrates side go rish di west for Gaza town. All Eufrates king dey under am and e dey make peace with all di kountries wey near am. 25 Judah and Israel pipol get peace thru-out di time wey Solomon dey rule and all di family get dia own grapevines and fig trees.
26 Solomon get 4,000 house for en shariot and 12,000 horse.
27 Na di twelf govnor dey bring di food wey Solomon and all di pipol for di palis go chop. Each one, for each mont. 28 Each govnor dey bring en own barley and straw for di shariot and animals wey dey work kom di propa place wey dem suppose take am go.
29 God give Solomon betta wisdom, sense and en undastandin big well-well. 30 Solomon get sense pass di wise men for east and for Egypt. 31 Na-im wise pass among all men. E wise pass Etan wey kom from Ezra and Heman, Kalkol, Darda wey bi Mahol shidren. So pipol kon dey tok about Solomon wisdom for all di kountries wey dey near Israel 32 E rite 3,000 parabol and di songs wey e rite, pass 1,000. 33 E rite about trees and plants, like di cedar wey dey Lebanon and di plant wey dey grow for wall. E still rite about animals, birds, animals wey dey creep and fish. 34 All di kings for di world hear about en wisdom, so dem kon send pipol go listin to am.