22
Mikah Warn Ahab
Peace kon dey between Israel and Siria for two years, but for di third year, King Jehoshafat for Judah go si King Ahab for Israel. King Ahab ask en ofisas, “Since na wi get Ramot for Gilead, wetin make us neva try to kollect am back from Siria king?”
So King Ahab ask King Jehoshafat, “Yu go follow mi go attack Ramot for Gilead?”
Jehoshafat ansa, “Mi and my sojas dey ready, if yu ready. But make wi ask God first.”
So King Ahab koll almost 400 profets kon ask dem, “Make I go attack Ramot for Gilead or not?”
Dem ansa, “Make yu go attack am, bikos God go make yu win.”
But King Jehoshafat ask, “E nor get anoda profet wey wi fit still ask?”
King Ahab ansa, “E get anoda one, en name na Mikaya wey Imlah born. But I hate am, bikos e nor dey profesai anytin wey dey good give mi, na only bad tin e dey tell mi.”
King Jehoshafat kon sey, “Make yu nor tok like dat!”
Den King Ahab koll di offisa for di kourt kon sey make e go bring Profet Mikaya kom.
10 Di two kings wear dia royal robes kon sidan for dia thrones for di gardin for Samaria gate and all di profets bigin profesai for dem. 11 One among dem wey en name na Kenaana wey Zedekaya born kon use iron make horn, den e tell King Ahab, “Dis na wetin God tok, ‘Na dis tin yu go take fight Siria pipol kon win dem finish.’ ”
12 All di oda profets tok di same tin kon sey, “Make yu go attack Ramot for Gilead and yu go win dem, bikos God go give yu viktory.”
13 Di ofisas wey go koll Mikaya kon tell am, “All di oda profets don profesai viktory give di king. So make yu do di same tin.”
14 But Profet Mikaya ansa, “I promise una with God wey dey alive sey, I go only tok wetin God sey make I tok!”
15 Wen Profet Mikaya rish where King Ahab dey, di king ask am, “Profet Mikaya, ‘Make mi and King Jehoshafat go attack Ramot for Gilead?’ ”
Mikaya ansa, “Make una go attack am, bikos God go give una viktory.”
16 But King Ahab ansa, “How many times I go tell yu sey, if yu dey tok to mi with God name, make yu dey tell mi di trut?”
17 So Mikah kon ansa, “I si Israel soja wey skata for evriwhere for di hill like sheep wey nor get who dey kare for dem. And God sey, ‘Dis men nor get leader, so make dem go dia house with peace.’ ”
18 Den King Ahab tell King Jehoshafat, “I nor tell yu sey e nor dey profesai anytin wey dey good for mi? Na only bad tin e dey profesai for mi!”
19 Mikah still sey, “Naw, make yu listin to wetin God tok! I si God wey sidan for en throne for heaven with all en angels as dem stand near am. 20 God ask, ‘Na who go-go deceive King Ahab, so dat dem go kill-am for Ramot Gilead?’
“Di angels kon dey tok difren tins, 21 until one spirit kom out kon tell God, ‘I go-go deceive am.’
22 “God ask am, ‘How yu wont take deceive am?’
“Di spirit ansa, ‘I go make all di profets lie for Ahab.’
“So God tell am, ‘Make yu go deceive am, bikos e go hear yu.’ ”
23 Profet Mikah still sey, “Dis na wetin don happen. God don make dis profets lie to yu. But en ensef don tok sey yu go si wahala!”
24 Den Profet Zedekaya wey bi Kenaana pikin, waka kom meet and slap Mikaya, den e ask am, “Since wen God Spirit leave mi kon dey tok to yu?”
25 Mikaya ansa, “Yu go know di trut, wen yu go-go back of yor house go hide.”
26 King Ahab kon give orda sey, “Make una arrest and karry Mikaya go Amon, di ofisas town and Joash, my pikin, dey der too. 27 Una go tell dem make dem put am for prison kon gi-am bread and wota till I go kom back.”
28 Mikaya ansa, “If yu kom back alive, den God nor tok thru mi!” E still sey, “Make all of una hear wetin I tok so o-o!”
Ahab Die
29 Den King Ahab for Israel and King Jehoshafat for Judah kon go attack Ramot town for Gilead. 30 King Ahab tell King Jehoshafat, “As wi dey go di war so, I go shange my klot, but make yu wear yor royal robe.” So Israel king shange kon go di war.
31 Siria king don kommand en thirty-two kommanders wey dey use shariot sey make dem nor attack anybody escept Israel king. 32 So wen dem si King Jehoshafat, all of dem tink sey na Israel king bi dat, so dem bigin attack am. But King Jehoshafat shaut, 33 den dem kon know sey e nor bi Israel king, so dem stop to attack am.
34 So one Siria soja trow en arrow kon shuk King Ahab for belle. King Ahab tell di man wey dey ride en horse, “Dem don wound mi! Make yu turn komot for here!” 35 As di war dey kontinue, King Ahab just dey for en shariot face Siria pipol. Di blood from en body kon kover en shariot, so e kon die for evening. 36 As evening dey rish, dem kon orda Israel pipol make dem dey go back to dia house.
37 Na so King Ahab take die and dem karry am go Samaria go beri. 38 Just as God sey e go happen, dem wosh di shariot for Samaria pool where ashawo for dey baf, den dogs kon dey lick Ahab blood.
39 Di remainin tins wey Ahab do wen e bi king; with evritin wey e get and how e build big palis and difren towns, dem rite dem for Israel kings history book. 40 Ahab die and en pikin, Ahazaya kon take-ova as king.
Jehoshafat Rule For Judah
41 For di fourt year wey Ahab bi king for Israel, Asa pikin, Jehoshafat kon bi king for Judah. 42 Jehoshafat na thirty-two years wen e start to rule and e rule Jerusalem for twenty-five years. En mama na Azuba, wey bi Shilhi pikin. 43 E do like en papa Asa kon dey obey and do only di tins wey God wont, but e nor skata di place where dem for dey woship juju, so di pipol kontinue to burn incense and offa sakrifice to dia juju. 44 Jehoshafat make peace with Israel king.
45 Di remainin tins wey King Jehoshafat do; with all en good works and di sojas wey e get, dem rite dem for Judah kings history book. 46 E remove all di men and wimen ashawo wey dey woship for di juju altars; di ones wey still remain wen Asa, en papa bi king. 47 For dis time, Edom nor get king, na govnor dey rule dem.
48 King Jehoshafat build plenty big ship wey dey travel go get gold for Ofir, but dem sink for Ezion-Geber. 49 Den King Ahazaya wey bi Ahab pikin kon tell King Jehoshafat sey, “Make my men join yor plenty ship,” But Jehoshafat nor gri.
50 King Jehoshafat die and dem beri am for en grand-grand papa, David Town. Jehoram en pikin kon take-ova as king.
King Ahazaya For Israel
51 For di sevent year wey Jehoshafat bi king for Judah, Ahazaya wey bi Ahab pikin kon dey rule Israel from Samaria. 52 E nor obey God and e dey do di kind bad-bad tins wey en papa and mama do. E make Israel pipol sin, just as Jeroboam wey bi Nebat pikin, tell dem to do. 53 E woship Baal kon make di Oga wey bi Israel pipol God vex and na so en papa do too.