16
God send Profet Jehu, Hanani pikin, go meet and give Baasha dis message: “Even doh yu nor important, I still make yu lead my pipol, Israel. Naw yu don disobey mi like Jeroboam kon make my pipol sin and dia sins don make mi dey vex. So, I go kill yu and yor family as I do Jeroboam. Anybody for yor family wey die for town, na dog go chop am and any one wey die for open field, na vulture go chop am.”
Evry oda tin wey Baasha do, dem rite am for Israel kings history book. King Baasha die and dem beri am for Tirzah. En pikin, Elah kon take-ova as king.
Na God give Profet Jehu di message wey e tok against King Baasha and en family, bikos of di sin wey dem kommit. Nor bi only en wikedness dey make God vex, but na bikos e kill evribody for Jeroboam family.
King Elah For Israel
For di twenty-sixt year wen Asa don bi king for Judah, Elah wey bi Baasha pikin kon bi king for Israel and e rule from Tirzah for two years.
Zimri, one among en ofisas wey dey kare for half of di king shariot, plan against am. One day for Tirzah, Arza wey dey kare for di palis, Elah go en house kon drink too mush for der. 10 Zimri enter di house kon kill and take-ova from King Elah. Dis tin happen for di twenty-sevent year wey Asa bi king for Judah.
11 As Zimri just bikom king, e kon kill evribody for Baasha family. E kill all di men wey rilate to Baasha kon still kill en friends. 12 So wetin God tok against Baasha thru Profet Jehu kon happen, bikos Zimri don kill evribody for Baasha family. 13 Bikos dem dey woship juju and dem make Israel pipol sin, King Baasha and en pikin Elah kon make di Oga wey bi Israel pipol God, vex well-well.
14 Evry oda tin wey Elah do, dem rite am for Israel kings history book.
King Zimri For Israel
15 For di twenty-sevent year wey Asa don bi king for Judah, Zimri kon rule Israel pipol from Tirzah for seven days, wen Israel sojas dey take-ova Gibbeton town for Filistia 16 and wen dem hear sey Zimri plan kill di king, for where all of dem dey, dem kon make Omri wey bi dia kommander, king for Israel. 17 Omri with en sojas komot from Gibbeton go take-ova Tirzah. 18 Wen Zimri si sey dem don take di town, e enter inside di palis inna room, lite fire for der kon die inside. 19 Dis tins happen, bikos e sin against God. E do bad tins like Jeroboam wey sin and enkourage Israel pipol to sin.
20 Evry oda tin wey Zimri do and how e plan against pipol, dem rite dem for Israel kings history book.
King Omri For Israel
21 Israel pipol kon divide, some of dem wont make Tibni wey bi Ginat pikin, bi dia king and di odas dey for Omri side. 22 At last doz wey dey Omri side kon win, bikos Tibni die and Omri kon bi king.
23 So for di thirty-first year wey Asa don dey rule Judah, Omri kon bi king for Israel and e rule for twelf years. Na from Tirzah e for rule for di first six years 24 and e buy Samaria hill with 6,000 silva from one man wey dem dey koll Shema, wey bin get di hill.
25 King Omri sin worse pass di sin wey doz wey don rule before am, do. 26 Like Jeroboam wey don rule before am, e make di Oga wey bi Israel God vex, bikos e sin and enkourage Israel pipol to serve juju.
27 Evry oda tin wey Omri do, dem rite am for Israel kings history book. 28 King Omri die and dem beri am for Samaria and en pikin, Ahab kon take-ova as king.
King Ahab For Israel
29 For di thirty-eight year wey Asa don bi king for Judah, Ahab wey bi Omri pikin kon bi king for Israel and e rule from Samaria for twenty-two years. 30 En own sin against God, worse pass all di pipol wey don rule before am. 31 E nor only kommit sin like Jeroboam, but e go marry Jezebel wey bi King Etbaal for Sidon, pikin and Ahab still dey woship Baal. 32 For Samaria, e build temple, make altar kon put Baal for inside. 33 E still build Asherah juju. Di tins wey e do, make God vex pass wetin all di oda kings for Israel don do before.
34 For di time wey e bi king, Hiel wey kom from Bethel kon build Jeriko again. As God don tok thru Joshua wey bi Nun pikin, Hiel first pikin, Abiram, die wen dem start to build Jeriko foundashon and en last born, Segub kon die wen dem dey won put di town gate.