13
God Profet And King Jeroboam
God tell one profet from Judah make e go Bethel and e rish der wen King Jeroboam stand for di altar dey do sakrifice. Just as God kommand, di profet curse di altar kon sey, “Dis altar! Dis altar! Na wetin God tok bi dis. Dem go born one pikin wey en name go bi Josaya for David family and e go kut and burn di pagan priest wey dey serve and do sakrifice for dis altar.” Di profet still sey, “Dis altar and di ashes wey dey inside, go skata. Den, yu go know sey God don tok thru mi.”
Wen King Jeroboam hear dis tin, e point kon sey, “Make una hold dat man!” At wons, di king hand paralaiz and e nor fit strait am again. Di altar fall and di ashes kon skata, just as di profet tok with God name.
King Jeroboam tell di profet, “Abeg! Make yu pray to di Oga yor God for mi sey, ‘Make E heal my hand!’ ” So di profet pray to God and di king hand kon strait again.
Den di king tell di profet, “Make yu kom chop for my house and I go give yu sometin.”
Di profet ansa, “Even if yu give mi half of evritin wey yu get, I nor go chop or drink anytin with yu. God kommand mi sey, make I nor chop or drink anytin and make I nor go back di wey I take kom here.” 10 So, di profet nor follow di road wey e take kom, go back.
Di Old Profet For Bethel
11 Dat time, e get one old profet for Bethel. E shidren kom tell am wetin di profet wey kom from Judah do for Bethel and di tins wey e tell King Jeroboam. 12 Di old profet ask dem, “Wish road e pass wen e dey go?” En shidren show am di road, 13 so e tell dem make dem ready en donkey. Afta dem ready am, di old profet enter kon 14 follow and meet di profet wey kom from Judah under one oak tree where e sidan.
Den e ask am, “Na yu bi di profet wey kom from Judah?”
Di profet ansa, “Yes! Na mi.”
15 So di old profet tell am, “Make yu kom my house kon follow mi chop.” 16 But di profet from Judah ansa, “I nor go fit follow yu go house or chop and drink anytin with yu, 17 bikos God don kommand mi sey make I nor chop or drink anytin for here or go back as I take kom.”
18 Den di old profet lie gi-am kon sey, “Mi too na profet like yu and God kommand mi thru en angel sey make I kare for yu for my house.” 19 So di profet wey kom from Judah follow di old profet go en house go chop.
20 As dem sidan for di tabol, God tok thru di old profet 21 and e shaut tell di profet wey kom from Judah, “God sey yu don disobey am, bikos yu nor do wetin E kommand, 22 but instead, yu kon go back go chop for where E sey make yu nor for chop. Bikos of wetin yu don do so, yu go die and dem nor go beri yu for yor family grave.”
23 Afta dem don chop finish, di old profet kon bring di Judah profet donkey kom. 24 And as di profet dey go for road, one lion kom out kon kill-am, den di lion and donkey kon stand near en dead body. 25 As some pipol dey pass, dem si di dead body for road with di lion wey stand near am. Den dem go Bethel go tok wetin dem si.
26 Wen di old profet hear wetin happen, e kon sey, “Dat na di profet wey nor obey wetin God kommand! So God send di lion go kill-am, just as E sey E go do.”
27 Den e tell en shidren, “Make una bring my donkey for mi,” Di shidren bring am and 28 e kon go si di profet dead body for road and di donkey and di lion still stand near am. Di lion nor chop di body or attack di donkey. 29 So di old profet karry di body put for di donkey kon go mourn and beri am for Bethel. 30 E beri am for en own family grave, den en and en shidren mourn for am and e kon sey, “Um, my broda, my broda!”
31 Afta dem beri am, di profet tell en shidren, “Wen I die, make una beri mi for dis grave where I beri dis profet put, den make una put my bones near en own. 32 Bikos all di tins wey God kommand, wey e tok against di altar for Bethel and di place wey dem for dey woship for Samaria town, must happen.”
Jeroboam Kommit Big Sin
33 King Jeroboam for Israel nor still shange from di bad tins wey e dey do, but e kontinue to dey choose priest from ordinary family make dem kon serve for di altar wey e build. Na pipol wey just like to bi priest, e dey make priest. 34 Dis sin wey e kommit kon make en kingdom skata rish groun.