35
Jeremaya With Rekab Pipol
Wen Josaya pikin Jehoiakim bi king for Judah, God kon tell mi, “Make yu go Rekab town go tok to di pipol, den make yu bring dem kom one of di room for di temple kon give dem wine drink.” So I go meet Jaazanaya (anoda Jeremaya pikin and Habazzinah grand-pikin) and en brodas with en shidren, plus evribody wey dey Rekab town kon take dem enter di temple. I take dem enter di room where Igdalaya pikin, Profet Hanan disciples dey stay. Di room dey near where di offisa for di temple dey stay and Maaseaya wey Shallum born, wey dey guide di temple, dey stay for di room wey dey up, inside di temple. Den I put cup and basin wey wine full for Rekab pipol front kon tell dem, “Make una take wine drink.” But dem ansa, “Wi nor dey drink wine, bikos awa grand-grand papa Jehonadab wey Rekab born tell us sey, make wi nor ever drink wine.” E still tell us sey, make wi nor build house, plant anytin or buy any vineyard for awasef. E kommand us sey make wi dey stay for tent, so dat wi go fit stay for dis land wey wi dey stay like strenjas. “So wi, awa wifes, sons and dotas dey obey wetin awa grand-grand papa, Jehonadab kommand us and since den, wi neva drink wine; build house for awasef; get vineyard or plant. 10 Na tent wi dey stay and wi dey obey evritin wey Jehonadab awa grand-grand papa, kommand us. 11 But wen King Nebukadnezzar for Babilon skata di land, wi sey make wi kom Jerusalem, so dat wi go fit eskape from Babilon and Siria sojas. Na dis make wi dey stay for Jerusalem naw.”
12 Den Israel God wey dey mighty 13 sey make I go tell Jerusalem and Judah pipol sey, “Mi wey bi God, dey ask una wetin make una nor gri listin to mi kon obey evritin wey I kommand. 14 But Jehonadab shidren-shidren obey wetin e kommand, wen e sey make dem nor drink wine. And until naw, dem neva drink wine. Even doh I dey always tok to una, una nor gri obey mi. 15 I send my savant, di profets kom meet una sey make una stop di bad tins wey una dey do kon do di korrect tin. Dem warn una sey make una nor woship and serve oda gods, so dat una go kontinue to stay for dis land wey I give una and una grand-grand papa, but una nor gri listin or hear dem. 16 Yes, Jehonadab shidren-shidren obey wetin e kommand dem, but una nor gri obey mi. 17 So, mi wey bi Israel God dey sey, ‘I go distroy Judah and Jerusalem pipol, even don I bin don promise dem good tins. I go do am, bikos una nor dey gri listin to anytin wey I tok and wen I koll una, una nor dey ansa.’ ”
18 Den I tell Rekab pipol: “Israel God wey dey mighty sey, ‘Una don obey evritin wey una grand-grand papa Jehonadab tell una; dey follow evritin wey e tish una and una don do evritin wey e kommand una.’ ” 19 So mi, wey bi Israel God promise sey, “Jehonadab wey bi Rekab pikin, go always get one of en sons wey go serve mi.”