3
Jonah Go Nineveh 
 
1 God kon tell Jonah for di sekond time,  
2 “Make yu go Nineveh, dat big town kon tell di pipol my message.”  
3 So Jonah obey God kon go Nineveh. (Nineveh na one big town and e go take three days to waka round am!)  
4 For di day wen Jonah enter di town, e kon tell di pipol, “Afta forty days, God go distroy Nineveh finish!”   
5 Nineveh pipol bilive God message, so dem kon sey make evribody fast and wear sak and evribody, both small and old, do wetin dia leaders tell dem.  
6 Wen dia king hear di news, e get up from en throne, remove en fine klot, wear sak kon sidan for ashes.  
7 E kon kommand, “For inside dis kingdom, Nineveh, mi and all my ofisas don gri sey: ‘Make nobody or animal, chop or drink anytin.  
8 Make evribody and dia animals wear sak kon pray well-well to God, den turn from dia sin go meet am.’  
9 May bi God go shange en mind kon stop to vex for us, den wi nor go die again!”  
10 So wen God si wetin dem dey do: sey dem don really turn kom meet am, E kon shange en mind and E nor ponish dem again, just as E bin won do.