12
Na breeze Efraim pipol dey chop.
Dem dey porshu breeze from morning go rish nite.
Dem dey gada lie and wahala
kon enter agriment with Assyria
and dey do business with Egypt pipol.
Naw, God get wetin E go tok against Judah pipol.
E go ponish Jakob shidren
bikos of di way dem dey bihave.
E go pay dem back for wetin dem don do.
Even for dia mama belle,
Jakob struggol with en broda Esau
and wen Jakob grow, e still struggol with God.
E fight with God angel kon win.
E beg di angel make e bless am.
E meet God for Bethel
and God kon tok with am for der.
Oga God wey dey mighty;
na God bi en name forever.
So, make una turn kom meet una God.
Make una show love;
dey judge well and dey patient
as una dey wait for God.
But Israel pipol nor dey tok true;
dem bi like Kanaan pipol wey dey shit
and play dia customers wayo.
Efraim pipol sey,
“Wi get money well-well
and nobody go fit akuse us
sey wi use wayo take get awa money.”
“But na mi bi di Oga una God
wey take una komot from Egypt;
I go make una stay for tent again,
just as e bi wen una dey do Shelta Feast.
10 I send my profets kon warn una
with many vishon and parabol.
11 But Jabesh-Gilead pipol nor mean anytin
bikos dem dey woship juju.
And dem dey sakrifice animals for Gilgal;
dia altars bi like stones
wey dem gada togeda for field wey dem klear.
12 Jakob run go Aram land.
For der, e kare for sheep, to take pay for en wife.
13 Na profet God take save Israel pipol from Egypt
where dem bi slave
and na profet e take guide dem.
14 But Efraim pipol make God vex well-well;
so E go ponish dem
bikos of di innocent pipol wey dem kill
kon pay dem back for dia sin.”