3
Habakkuk Prayer 
 
1 Dis na di prayer wey Profet Habakkuk pray:   
2 My God, I don hear evritin wey Yu do  
and e sopraiz mi well-well.  
Even naw for awa time,  
make Yu still do dat wonderful tin wey Yu do before.  
Even wen Yu dey vex, make Yu sorry for us.   
3 God dey kom from Teman;  
God wey dey holy dey kom from Mount Paran.  
En glory kover di heavens  
and na en praiz full di eart.   
4 E dey shine like sun as E dey kom  
and lite dey shine from en hand,  
where en pawa der.   
5 E send diziz go for en front  
kon kommand deat follow am for back.   
6 Wen E stop, di eart go start to shake  
and wen E look, di nashons go bigin fear.  
All di mountins go skata;  
di hills wey dey since go sink  
and E go dey forever and ever.   
7 I si Kushan pipol dey fear  
and as Midian pipol dey waka dem kon dey fall.   
8 My God, na di sea make Yu dey vex?  
Yu really dey vex for di river dem?  
No! Yu dey kom with yor shariot kon save us!   
9 Yu dey ready to use yor bow kon shot yor arrow.  
Yor lite for heaven dey divide di eart into two.   
10 Mountins dey fear as dem si Yu;  
rain dey fall from di kloud  
and waves for sea dey raiz  
and make nois bikos of Yu.   
11 As dem si yor arrow dey kom with speed  
and as yor spear dey shine,  
di sun and di moon nor fit move  
komot from where dem dey.   
12 Yu vex mash pass di eart  
and as Yu dey vex,  
Yu kon skata all di nashons.   
13 Yu go save yor pipol  
and di king wey Yu choose.  
Na Yu kill di pesin wey dey lead wiked pipol  
kon distroy doz wey dey follow am.   
14 Wen en sojas gada dey kom like strong breeze  
to kom skata and opress us,  
Yu kill dem with yor arrow.   
15 Yu mash di sea with yor horse  
and di mighty river kon dey foam.   
16 I fear well-well wen I hear all dis tins  
and my lips kon dey shake.  
Fear and kold katch mi at wons.  
I go really wait for di time wen God go ponish  
doz wey dey attack us.   
17 Even doh di fig and olive tree nor get fruit naw  
and di grape nor gri grow for di vine  
or sey di land produce korn  
and all di animals don die,   
18 I go still dey happy and sing for joy,  
bikos na Oga God dey guide mi.   
19 God wey get pawa dey give mi strent.  
E make mi stand strong for groun  
like deer kon keep mi save on-top di mountin.  
(For di kwayamasta:  
Make dem sing dis song with instrument like, jita.)