43
Dem Go Egypt Again
Naw di honga strong well-well. So wen dem don chop di food wey dem buy from Egypt finish, dia papa kon tell dem, “Make una still go back go buy some food kom.”
But Judah tell en papa sey, “Di oga for der really warn us sey, ‘Una nor go si my face unless una bring una broda.’ But if yu allow awa broda follow us, den wi go-go buy food. But if yu nor gri make e follow us, wi nor go-go, bikos di man sey, ‘Una nor go si my face unless una bring una broda kom.’ ”
So Israel sey, “Wetin make una kause dis wahala wen una tell di man sey una get anoda broda?”
Dem ansa, “Di man ask us kweshon well-well about wi and awa family sey, ‘Una papa still dey alive? Una get anoda broda? So wi ansa am like dat.’ How wi won take know sey e go sey, ‘Make una bring una broda kom’?”
Den Judah tell en papa Israel sey, “Make yu allow di boy follow mi and wi go-go togeda. Den wi go dey alive and wi nor go die, both wi, yu and awa shidren. Mi mysef dey swear sey e go dey save; make yu hold mi if e nor kom back. 10 And if nor bi all dis story, wi for don go der kom back like two times naw!”
11 Den dia papa Israel tell dem, “If na so e go bi, den make una do dis tin for mi: Make una karry some among di best tins wey wi get put for una bags kon give di man as gift; small balm, honey, spices and myrrh, pistachio and almond. 12 Make una take many money follow body; una must return dat money wey una si for una bag, bikos e if bi sey dem dey try una. 13 Naw, make una karry Benjamin una broda and make una dey go. 14 Make di God wey get pawa give una mesi for di man front, so dat e go release Simeon and Benjamin! But for mi, if I luz my shidren, I luz dem bi dat.”
15 So dem take di gift, karry doubol money kon take Benjamin follow body. Den dem rush go Egypt kon stand for Josef front. 16 Wen Josef si Benjamin with dem, e kon tell en savant wey dey kare for en house, “Make yu take dis men go my house, den make yu kill one animal kon kook am, bikos dis men go chop with mi dis aftanoon.” 17 Di man do just as Josef tell am; e take di men go Josef house.
18 But di men kon dey fear wen dem take dem enter Josef house. Dem kon sey, “Dem bring us kom here, bikos of dat money wey wi si for awa sak dat time. E won katch us, turn us to en slave kon take awa donkey!”
19 So dem go meet di man wey dey kare for Josef house kon follow am tok for di door-mot. 20 Dem tell am, “My oga, wi really kon buy food di first time. 21 But wen wi rish where wi won for sleep dat nite, wi open awa sak and all of us si awa money; dat is di whole money for inside di sak. So wi don riton am. 22 Wi still bring xtra money wey wi go take buy food. Wi nor know who put di money dem for awa sak!”
23 Di man kon tell Josef brodas sey, “Make una nor fear, evritin dey okay. Una God and una papa God don give una gift for una sak. Na mi put di money.” Den e bring Simeon kom out from prison.
24 Di man kon take dem enter Josef house. E give dem wota and dem kon wosh dia legs. Den e give dia donkey food chop. 25 Josef brodas kon keep dia gifts dey wait make Josef kom for aftanoon, bikos dem don tell dem sey dem won chop with am.
26 Wen Josef enter di house, dem kon gi-am dia gift and dem bow face groun for en front. 27 E ask dem how dem dey. Den e sey, “Una papa dey okay, di one wey una tok about? E still dey alive?”
28 Dem kon ansa, “Yor savant wey bi awa papa dey okay and e still dey alive.” Den dem bow to show respet.
29 Wen Josef look up kon si en broda Benjamin, en mama pikin, e kon sey, “Na dis boy bi una yonga broda wey una tell mi about?” Den e sey, “My son, make God always dey good to yu.” 30 Josef rush go outside, bikos e nor fit bear as e dey si en brodas and e don nearly won kry. So e go en room kon kry well-well for der. 31 Den e wosh en face kon kom out. With strong mind, e kon sey, “Make una arrange di food.”
32 Dem arrange one place for am, anoda place for en brodas and anoda place for di Egypt pipol wey won chop with am. (Dis na bikos, Egypt pipol nor dey chop with Hibru pipol, bikos Egypt pipol bilive sey e nor good to chop with Hibru pipol.) 33 Dem sidan for en front as dem take born dem; from di first-born go rish di last born. Di men kon dey sopraiz dey look demsef. 34 E give dem part for di food wey dem gi-am, but di one wey e give Benjamin, big pass dia own five times. Dem chop and drink with Josef until drink kon katch dem.