38
Judah And Tamar
For dat time, Judah leave en brodas kon go stay with one man wey kom from Adullam and en name na Hirah. For der, Judah si one girl wey kom from Kanaan and en papa name na Shua. Judah marry and sleep with am. Di girl get belle kon born boy and Judah koll am Er. Di woman get belle again kon born anoda boy and en mama koll am Onan. Den e kon born anoda boy and e koll am, Shelah and e born dis one for di town wey dem dey koll Kezib.
Judah kon marry wife give Er en first-born and di woman name na Tamar. But Er, Judah first-born kon sin against God, so God kon kill-am. Den Judah tell Onan en pikin, “Make yu sleep with yor broda wife, make e for fit born for yor broda.”
But Onan know sey di pikin nor go bi en own. So wen ever e dey sleep with en broda wife, e dey kwik get up, so dat e nor go born shidren for en broda wey don die. 10 So wetin E do kon make God vex, so God kon kill-am too.
11 So Judah kon tell en pikin wife Tamar sey, “Make yu go stay for yor papa house as woman wey en husband die until my pikin Shelah go grow rish to marry yu.” Bikos e tink for en mind sey, “I nor wont make Shelah die like en brodas.” So Tamar kon go stay for en papa house.
12 Afta sometaim, Judah wife wey bi Shua pikin kon die. Afta Judah don mourn for am, e kon go Timnah go visit doz wey dey barb sheep hair with en friend Hirah wey kom from Adullam. 13 Dem kon tell Tamar sey, “Si, yor husband papa dey go Timnah go barb sheep hair.” 14 So e shange en klot kon kover ensef make nobody si en face. E wrap ensef kon sidan for di door-mot for Enaim where dem dey pass go Timnah. (Di woman do like so, bikos e si sey dem nor gri gi-am to Shelah as wife, even doh di boy don big naw.) 15 Wen Judah si am, e tink sey na ashawo, bikos e kover en face. 16 So e turn face am for di road kon sey, “Make yu kom! I like sleep with yu.” (Judah nor know sey na en pikin wife.)
Di woman ansa, “Na wetin yu go give mi afta yu don sleep with mi?”
17 Judah ansa, “I go give yu one small goat from my animals.”
Di woman ansa, “Wetin yu go give mi, make I for know sey yu go send di goat kom?”
18 Judah sey, “Na wetin yu wont make I give yu?”
Di woman ansa, “Make yu give mi yor seal, waist belt and di rod wey dey yor hand.” So Judah give dem to am kon sleep with am. So Tamar kon get belle for Judah. 19 Di woman komot for der at wons, remove di klot kon wear di klot wey show sey e dey mourn.
20 Den Judah kon give en friend Hirah from Adullam one yong goat make e go give di woman, so dat e go gi-am back all di tin wey e gi-am before, but wen Hirah rish der, e nor si am again. 21 E ask di men wey dey der sey, “Where di ashawo wey dey here for Enaim road?”
Dem ansa am, “Wi neva si any ashawo for here before.” 22 So Hirah go back go tell Judah, “I nor si di ashawo for der. And di men for di place sey, ‘Dem neva ever si ashawo for der before.’ ”
23 Judah kon sey, “Make di ashawo keep doz tins for ensef. If not e go bi like sey wi nor bi betta pipol. I really send di yong goat go, but wi nor si am.”
24 Afta three monts, dem kon tell Judah sey, “Yor pikin wife Tamar don turn to ashawo and e don get belle.” Judah kon sey, “Make una go bring Tamar kom make dem burn am!”
25 As dem dey bring am kom out, e kon sey make dem go tell en husband papa sey, “Na di man wey get dis tins give mi belle.” Den di woman sey, “Make yu find di pesin wey get dis seal, waist belt and rod.”
26 Judah know sey di tins na en own so e sey, “Dis woman even dey good and raitious pass mi, bikos I nor gri gi-am to Shelah my son.” So Judah nor gri sleep with am again.
27 Wen time rish for Tamar to born, na twins e born. 28 Wen e dey born, one pikin bring en hand kom out, so di nurse tie dat hand with rope kon sey, “Na dis one first kom out.” 29 But di pikin take en hand go inside back and en broda kon kom out before am. Tamar sey, “Si as yu take kom out from my belle!” So e koll di pikin, Perez. 30 Leta en broda kom out with di rope for en hand, so e koll am Zera.