36
Esau Shidren-shidren
Dis na di shidren wey Esau (wey bi Edom) born. Esau marry from Kanaan and di woman name na Adah and na Elon wey kom from Hit bi en papa. E still marry Oholibama, wey bi Anah pikin and na Zibeon wey kom from Hiv, na en grand-papa. E still marry Basemat wey bi Nebaiot sista and na Ishmael bi dia papa. Adah born Elifaz for Esau and Basemat born Reuel. Oholibama born Jeush, Jalam and Korah. All dis na Esau sons wey dem born for Kanaan.
Esau take en wifes, en shidren, evribody wey dey with am and en animals and evritin wey e get wey e buy from Kanaan kon go anoda land wey nor dey near en broda Jakob, bikos dia propaty too many and dem nor fit stay togeda, bikos di land wey dem dey, nor big rish. So Esau (wey still bi Edom) kon go stay for di hill for Seir.
Dis story na about Esau, Edom pipol papa for di hill aria wey dey Seir.
10 Dis na Esau sons name: Elifaz wey Esau wife Adah born; Reuel wey Esau wife Basemat, born. 11 Elifaz sons na: Teman, Omar, Zefo, Gatam and Kenaz. 12 Elifaz wey bi Esau pikin, en girl-friend Timna kon born Amalek for am. Dis na di sons wey Esau wife Adah, born.
13 Reuel sons na: Nahat, Zera, Shammah and Mizzah. Na Esau wife Basemat born dis shidren.
14 Esau wife Oholibama wey bi Anah pikin and Zibeon grand-pikin, na di sons wey e born for Esau bi dis: Jeush, Jalam and Korah.
 
15 Di shiefs among Esau shidren; among en first-born Elifaz sons na: shief Teman, shief Omar, shief Zefo, shief Kenaz, 16 shief Korah, shief Gatam and shief Amalek. Dis na di shiefs wey kom from Elifaz for Edom land and dem bi Adah sons.
17 Reuel wey Esau born, na en sons bi dis: shief Nahat, shief Zera, shief Shammah and shief Mizzah. All dis na di shiefs wey kom from Reuel for Edom land and dem bi Basemat sons.
18 Dis na di sons wey Esau wife Oholibama born: shief Jeush, shief Jalam and shief Korah. Na Esau wife Oholibama wey bi Anah pikin, born all dis shiefs.
19 All dis na Esau (wey bi Edom) sons and dia shiefs.
Seir Shidren-shidren
20 Seir wey kom from Horite na en sons for di land bi dis: Lotan, Shobal, Zibeon, Anah, 21 Dishon, Ezer and Dishan. Dis na di shiefs from Horite wey bi Seir shidren-shidren for Edom land.
22 Lotan sons na Hori and Homam; Lotan sista na Timna.
23 Dis na Shobal sons: Alvan, Manahat, Ebal, Shefo and Onam.
24 Na Zibeon sons bi dis: Aiaya and Anah (wey si di hot spring for di wildaness as e dey guide di animals wey bi en papa Zibeon own).
25 Anah shidren na: Dishon and Oholibama wey bi Anah dota.
26 Na Dishon sons bi dis: Hemdan, Eshban, Itran and Keran.
27 Ezer sons na: Bilhan, Zaavan and Akan.
28 Dishan sons na: Uz and Aran.
29 Di shiefs for Horite na: shief Lotan, shief Shobal, shief Zibeon, shief Anah, 30 shief Dishon, shief Ezer and shief Dishan. All dis na di shiefs for Horite akordin to di shief list for Seir land.
Edom Kings
31 Dis na di kings wey rule for Edom land before any king rule for Israel:
32 Beor pikin Bela, rule for Edom; di town name na Dinhabah.
33 Wen Bela die, Jobab wey bi Zera wey kom form Bozrah kon rule for der.
34 Wen Jobab die, Husham wey kom from Teman kon rule for der.
35 Wen Husham die, Hadad wey bi Bedad pikin kon win Midian pipol for Moab land, den e rule for der. Di town name na Avit.
36 Wen Hadad die, Samlah wey kom from Masrekah kon rule for der.
37 Wen Samlah die, Shaul wey kom from Rehobot near di river kon rule too.
38 Wen Shaul die, Baal-Hanan wey bi Akbor son kon rule for der.
39 Wen Akbor pikin, Baal-Hanan die, Hadad kon rule for der; di town name na Pau. En wife name na Mehetabel wey bi Matred dota and Matred na Me-Zahab dota too.
40 Dis na di shiefs name for Esau family, akordin to dia family, place and dia names. Dem bi: shief Timna, shief Alvah, shief Jetet, 41 shief Oholibama, shief Elah, shief Pinon, 42 shief Kenaz, shief Teman, shief Mibzar, 43 shief Magdiel and shief Iram. All dis na di shiefs for Edom, akordin to where dem stay for di land wey dem kollect. Esau wey bi Edom pipol papa, na en story bi dis.