29
Jakob Marriage
So Jakob kon dey travel until e rish di land where pipol dey for east. For di field, e si one well and three sheep liedan near di well, bikos di sheep dey drink wota from di well. Wen all di sheep don gada for der, di pesin wey dey guide dem go roll di stone komot from di well mout for di sheep to drink wota. Den, afta dem don drink finish e go put di stone back for di well mout. Jakob kon ask am, “My brodas, where una from kom?”
Dem ansa, “Na from Haran.”
So Jakob tell dem, “Una know Laban wey bi Nahor grand-pikin?”
Dem ansa, “Wi know am.”
Jakob kon ask, “E dey okay.”
Dem ansa, “Yes! E dey okay. Naw, si en dota Rashel dey kom with di sheep.”
Den Jakob sey, “Since na still aftanoon, e neva rish time to gada di sheep. Make yu give di sheep wota kon let dem still go chop.”
Dem kon ansa, “Wi nor fit. Na only wen di sheep dey togeda and wi don roll di stone komot for di mout, dat na di only time wey wi fit give dem wota drink or wosh dem.”
As e still dey tok to dem, Rashel rish der with en papa sheep, bikos na en dey guide dem. 10 Wen Jakob si Rashel wey bi en mama broda Laban dota and di sheep, e kon waka go remove di stone for di well mout kon give en mama broda sheep wota make dem drink. 11 Den Jakob kiss Rashel kon dey kry. 12 Wen Jakob tell Rashel sey e rilate to en family and na Rebekah, Laban sista bi en mama, Rashel run go tell en papa.
13 Wen Laban hear wetin en pikin tok about Jakob, wey bi en sista pikin, e kon run go meet am. E hold am tight kon kiss am, den e karry am go house. Jakob tell Laban how e take rilate to am. 14 Den Laban tell am, “Yu really bi my own flesh and blood.” So Jakob stay with Laban for one mont.
Jakob Serve Laban
15 Den Laban tell Jakob, “Yu won work for mi for nor-tin bikos yu rilate to mi? Make yu tell mi wetin yu wont make I take pay yu.”
16 (Laban get two girl pikin; di senior one name na Leah and di yonga one na Rashel. 17 Leah eyes fine well-well, but Rashel get betta body with fine shape.) 18 Since Jakob don love Rashel well-well, e kon sey, “I go serve yu for seven years, so dat I go fit marry yor yonga dota, Rashel.”
19 Laban ansa, “E betta make I gi-am to yu dan any oda man. Make yu stay with mi.”
20 So Jakob work for seven years to marry Rashel. But di seven years bi like seven days for en eye, bikos di way e love Rashel, strong well-well. 21 So Jakob kon tell Laban, “Make yu give mi my wife make I marry, bikos di seven years don komplete.”
22 So Laban invite all di pipol for dat place kon do party. 23 For dat evening, e bring en dota, Leah kon give Jakob and Jakob kon marry am. 24 (Laban give en savant Zilpah to Leah, so dat e go bi Leah savant.)
25 For morning, Jakob kon find out sey na Leah e sleep with! So Jakob tell Laban, “Wetin yu do mi so! Nor bi bikos of Rashel make mi work for yu? Wetin make yu deceive mi?”
26 Laban ansa, “Awa tradishon for here nor dey gri make di yonga sista first en senior sista marry. 27 Make yu do evry normal tin wey yu suppose do for di senior one, den I go give yu di yonga one, afta yu don work for mi for anoda seven years.”
28 Jakob kon do as Laban tok. Wen Jakob don do all di tins wey e suppose do, Laban kon gi-am en sekond pikin, Rashel. 29 (Laban give en savant Bilhah to Rashel, so dat e go bi en savant.) 30 Jakob kon sleep with Rashel too. E love Rashel pass Leah, so e work for Laban for anoda seven years.
Jakob Family
31 Wen God si sey Jakob nor love Leah like dat, E kon make am get belle, while Rashel nor fit born. 32 So Leah get belle kon born boy. E name am Reuben kon sey, “God don sorry for mi, bikos of my kondishon. True-true, my husband go love mi naw.” 33 Leah get belle again kon born anoda boy. E kon sey, “Bikos God hear sey my husband nor love mi, E don give mi dis one too.” So Leah kon koll am Simeon. 34 Leah get belle again and e born anoda boy. E kon sey, “Naw dis time, my husband go love mi, bikos I don born three boy pikin.” Dat na why e koll am Levi. 35 Leah still get belle again and e born anoda boy. E kon sey, “Dis time I go praiz God.” Dat na why e koll am Judah. Den Leah nor kon born again.