22
God Test Abraham
So afta sometaim, God kon test Abraham. God koll am, “Abraham!”
Abraham ansa, “Na mi bi dis!”
God kon sey, “Make yu take yor pikin Isaak, yor only boy wey yu love and make una dey go Moraya! Den yu go offa am to mi as ofrin for one mountin wey I go show yu.”
For early morning di next day, Abraham kon get up go ready en donkey. E take two of en savants follow body plus en pikin, Isaak. Wen e don kut di wood for di ofrin, e kon bigin go di place wey God tell am. For di third day, Abraham kon si di place from far. So e kon tell en savants, “Make una two wait for here with di donkey, but mi and di boy go-go up for der. Wi go woship God kon kom back.”
Abraham take di wood for di ofrin kon karry am put for en pikin Isaak head. Den e take di fire and di knife and di two of dem kon waka dey go. Isaak ask en papa, “My papa?”
Abraham ansa, “My pikin, na wetin?”
Isaak kon sey, “Si di fire and di wood for here, but where di lamb wey wi go use for di sakrifice?”
Abraham ansa en pikin, “God go provide di lamb wey wi go use for di ofrin.” Den di two of dem kon waka go.
Wen dem rish di place where God tok about, Abraham kon build altar for der and e arrange di wood on-top. Den e tie Isaak hand and leg kon put am on-top di altar. 10 Den Abraham take di knife won kon kill en pikin. 11 But God angel koll am from heaven, “Abraham! Abraham!”
Abraham ansa, “Si mi for here!”
12 Di angel kon sey, “Make yu nor do di boy anytin, nor wound am. Naw! I don know sey yu dey fear God, bikos yu even ready to kill yor only pikin for mi.”
13 Abraham look up kon si one ram for en back, wey dey for trap for di bush. So e go karry di ram kon offa am to Oga God instead of en pikin. 14 So Abraham koll di place, “Jehovah-Jireh, wey mean (God dey provide).” And till today dem dey sey, “For God mountin, E go provide evritin.”
15 God angel koll Abraham again from heaven 16 kon tell am, “God sey, ‘I promise yu with my own name sey, bikos yu don do like dis kon give mi yor son, yor only pikin, 17 I go really bless yu kon make yor shidren-shidren plenty well-well and nobody go fit kount dem, just as nobody fit kount stars for sky or di san-san wey dey near river. Yor shidren-shidren go take all di tins wey bilong to dia enemies. 18 Bikos yu don obey mi, evribody go get blessing, bikos I go bless yor shidren-shidren.’ ” 19 Den Abraham go back go meet en savants and dem kon go back to Beersheba, where Abraham dey stay.
Nahor Shidren-shidren
20 Afta all dis tins, dem kon tell Abraham sey, “Milka sef don born shidren for yor broda Nahor 21 and na Uz bi first-born, en brodas na Buz, Kemuel (Aram papa), 22 Kesed, Hazo, Pildash, Jidlaf and Betuel.” 23 (Naw Betuel kon bi Rebekah papa.) Dis na di eight shidren wey Milka born for Nahor, Abraham broda. 24 En savant Reumah still born shidren for am and dia names na: Tebah, Gaham, Tahash and Maaka.