10
Di Pipol Konfess Dia Sin
Wen Ezra dey pray, kry and konfess all dis sins for di temple front, many pipol, both men, wimen and shidren stand round kon join am dey kry. Den Shekanaya wey bi Jehiel pikin wey kom from Elam family kon tell Ezra, “Wi nor dey faithful to God, bikos wi go marry doz strenj wimen, but even with dat, Israel still get hope. Naw wi must make promise give awa God sey wi go send doz wimen and dia shidren go. Wi go do anytin wey yu and di odas wey dey respet God advise sey make wi do. Wi go do wetin God law kommand. So make yu get up, bikos na yor rite to take akshon. Wi dey yor back, so go do as yu fit sey God wont.”
So Ezra get up kon make di leaders among di priests, Levi pipol and all Israel pipol swear sey dem go do anytin wey Shekanaya tok. Den e get up from di temple front kon enter Jehohanan wey bi Eliashib pikin room. E dey der thru-out dat nite dey kry for di pipol sin. E nor chop or drink anytin.
Den, dem kon send message go evriwhere for Jerusalem and Judah sey make evribody wey kom back from Babilon gada for Jerusalem. Anybody wey nor kom before three days finish, dem go seize all en propaty and e go luz en rite as memba for di kommunity.
Before di days finish, for di twenteth day for di ninet mont, all di pipol wey dey stay for Judah and Benjamin aria kom gada for Jerusalem for di temple front. Heavy rain dey fall, so evribody kon dey fear, bikos of di weda and di matter wey make dem gada. 10 Priest Ezra stand up kon tell dem, “Una don kommit strong sin as una go marry doz wimen wey bi strenjas. Una don add join Israel wahala. 11 Naw, make una konfess una sins give di Oga wey bi una grand-grand papa God kon start to do wetin go make belle sweet am. Make una separate unasef from doz strenjas wey dey for awa land and drive all una wife wey nor kom from Israel tribe.”
12 So di pipol shaut ansa, “Wi go do anytin wey yu tok. 13 And dem still sey, Di crowd too many and heavy rain dey fall. Wi nor go fit stand for outside like dis. Dis nor bi wetin wi go fit finish for one or two days, bikos wi many wey kommit dis sin. 14 Make awa leaders handle di matter. Den make doz wey marry woman from anoda kountry, kom gada with di leaders and judge dem for di town for di time wey dem gri sey make wi meet, until God nor go dey vex for us again.” 15 Nobody tok against dis plan escept Jonatan wey Asahel born; Jahzeaya wey bi Tikvah pikin and Meshullam and Shabbetai wey bi Levi, dey support dem too.
16 Di pipol wey kom back from Babilon asept di plan, so Priest Ezra kon choose some men from among di leaders den rite dia names down. So dem sidan togeda for di first day for di tent mont kon tok about di matter 17 and for di first day for di first mont, dem judge all di men wey marry wimen from anoda kountry.
Doz With Strenjas As Wife
18 Dis na di names of di men wey marry wimen from anoda kountry: From di priests akordin to dia family:
From Jeshua and en brodas Jehozadak family: Maaseaya, Elieza, Jarib and Gedalaya. 19 Dem promise sey dem go divorce dia wifes and dem offa ram as sakrifice for dia sins.
20 From Imma family: Hanani and Zebadaya.
21 From Harim family: Maaseaya, Elijah, Shemaya, Jehiel and Uzzaya.
22 From Pashhur family: Elioenai, Maaseaya, Ishmael, Netanel, Jozabad and Eleasah.
23 From Levi family: Jozabad, Shimei, Kelaya (wey dem still dey koll Kelita), Petahaya, Judah and Elieza.
24 Doz wey dey sing: Eliashib. Di temple guards na: Shallum, Telem and Uri.
25 Odas name na: From Parosh family: Ramaya, Izzaya, Malkijah, Mijamin, Eleazar, Makijah and Benaya.
26 From Elam family: Matanaya, Zekaraya, Jehiel, Abdi, Jerimot and Elijah.
27 From Zattu family: Elioenai, Eliashib, Matanaya, Jerimot, Zabad and Aziza.
28 From Bebai family: Jehohanan, Hananaya, Zabbai and Atlai.
29 From Bani family: Meshullam, Malluk, Adaya, Jashub, Sheal and Jerimot.
30 From Pahat-Moab family: Adna, Kelal, Benaya, Maaseaya, Matanaya, Bezalel, Binnui and Manasseh.
31 From Harim family: Elieza, Isshaya, Malkijah, Shemaya, Simeon 32 Benjamin, Malluk and Shemaraya.
33 From Hashum family: Mattenaya, Matatta, Zabad, Elifelet, Jeremai, Manasseh and Shimei.
34 From Bani family: Maadai, Amram, Uel, 35 Benaya, Bedeaya, Keluhi 36 Vanayah, Meremot, Eliashib 37 Matanaya, Mattenaya and Jaasu.
38 From Binnui family: Shimei, 39 Shelemaya, Natan, Adaya, 40 Maknadebai, Shashai, Sharai, 41 Azarel, Shelemaya, Shemaraya, 42 Shallum, Amaraya and Josef.
43 From Nebo family: Jeiel, Mattitaya, Zabad, Zebina, Jaddai, Joel and Benaya.
44 Na all dis men marry wimen from anoda kountry. Dem divorce dem kon porshu dem and dia shidren kom from Israel.