19
Sorrow Song 
 
1 God sey make I sing dis sorrowful song for di prince dem wey dey Israel:   
2 “Una mama na really strong lion  
wey train en shidren  
for where oda wiked lions dey.   
3 E tish one among en shidren  
how e go take katch oda animals  
and naw, e dey chop human being.   
4 But pipol for oda nashons hear about am,  
so dem tie and trow am inside pit  
kon drag am with hook go Egypt.   
5 Wen di mama wait kon si sey en pikin  
nor dey kom back again,  
e kon train anoda lion  
wey wiked pass di first one.   
6 Wen dat one don big,  
e kon start to katch animals  
and chop human being like oda lions.   
7 E skata where sojas dey guide well  
and distroy dia towns.  
Di way e dey shaut,  
dey make di pipol for di land dey fear.   
8 Pipol gada kom from evriwhere  
kon fight am.  
Dem spread dia net  
kon katch am with dia trap.   
9 Den dem put am for kage  
kon karry am go give Babilon king.  
Dem put am for prison,  
so dat pipol nor go hear en vois again  
on-top Israel mountin.   
   
 
10 Yor mama bi like vine wey dem plant near wota  
wey get fresh leaf and dey bear good fruits.   
11 En branches strong well-well like royal rod.  
Di vine grow and tall well-well.  
Yes! Evribody si as e tall rish  
and how en leaf fine.   
12 But wiked pipol kon kut am down.  
Di wind blow kon dry all en fruit.  
En branches dem break komot  
kon dry and fire burn dem.   
13 Naw, dem plant am for desert;  
di place wey dry and nor get wota.   
14 Den fire katch di vine  
kon burn evritin  
plus en fruit finish  
and e nor go ever strong again.  
E nor go ever bi dat royal rod again.  
“Dis na di sorrowful song wey dem go always dey sing.”