8
Obey Di King
Na who wise and get sense?
Na Who know di ansa to dis problem?
Wisdom dey make pesin smile
and remove vexnashon from en face.
So since yu don promise God sey yu go dey loyal to am, den make yu obey di king kommand. Make yu nor rush komot from di king present; nor put yor hand for bad tin, bikos di king fit do anytin wey e like. Anytin wey e kommand, pawa dey follow am and nobody go fit go against or kweshon en authority.
Di king nor go ponish pesin wey dey obey am and doz wey dey wise,
go find di way and time to do wetin dey good.
E get time and how to do tins;
bikos di king ponishment dey strong well-well.
True-true, nobody know tumoro
and nobody fit tell anoda pesin wetin go happen tumoro.
Wi nor fit kontrol breeze
or tok di day wen wi go die.
Dat na one war wey wi nor fit run from
and wikedness nor go fit save doz wey dey do evil.
All dis tins wey dey happen for dis world, I don tink about dem well-well kon si sey time dey for pesin to opress en neighbour as e like.
Against Di Law
10 I si as dem beri wiked pipol with honor, but God pipol dey komot di holy town and pipol dey forget dem. All dis tins nor make sense at-all.
11 Wen dem nor kwik ponish pesin wey do bad, pipol go tink sey e dey good to do bad. 12 If pipol wey sin hundred times still get long life, den I know sey pipol wey dey fear God, na dia life go long pass. 13 But wiked pipol nor go prosper, bikos dem nor dey fear God. Dia life go kwik finish like pesin shadow.
14 E still get oda yuzles tins for dis world: Sometaims, wi dey trit good pipol like sey dem wiked, den trit wiked pipol like sey dem dey good and na dis dey yuzles pass. 15 So I sey make wi dey enjoy awasef, bikos di only good tin for dis world na to dey chop, drink and enjoy awa short life. Na so wi go take enjoy di happiness and hard work wey God give us to do for dis world.
16 But for day and nite, I nor dey sleep bikos I dey try to undastand wetin dey happen for dis world. 17 I notis sey nobody go fit know evritin wey God dey do for dis world. Aldo wise pipol fit klaim sey dem know, but dem nor know anytin at-all.