4
Opreshon For Dis World
Den I tink of all di wiked tins wey dey happen for dis world.
I si pipol wey dem dey opress,
dey kry and nobody dey to help dem.
Nobody dey to save dem from doz pawaful men
wey dey opress dem.
So I sey, e betta well-well for pipol wey don die,
pass doz wey still dey alive.
But di ones wey dia own betta pass,
na shidren wey dem neva born,
bikos dem neva si all di wiked tins
wey dey happen for dis world.
Dey Vex, Dey Work
Den I tink of all di work wey pipol dey do and I kon si sey, evritin wey dem dey do, na to know who betta pass. But all dis tins dey yuzles too, e just bi like wen pesin dey porshu breeze.
Foolish pesin dey fold en hand and nor dey work,
so e nor get anytin to chop, escept en own flesh.
E betta make yu get small propaty with peace for mind,
dan to dey work hard,
bikos yu nor go still gain anytin
and e bi like wen pesin dey try to katch breeze.
Work Bikos Of Long-trot
I still notis anoda tin for life wey dey yuzles.
E get one man wey dey stay alone, e nor get pikin or broda,
but e dey work hard to get more propaty.
But e ask ensef,
“Na who I dey work for sef wey make mi nor dey fit enjoy mysef?”
All dis tins dey yuzles well-well o-o!
Reward To Work Togeda
Two pipol betta pass one pesin,
bikos dem get betta reward for dia work.
10 Bikos if one pesin fall, di oda pesin go help am stand.
But pesin wey dey alone, e go bad well-well for am wen e fall.
11 Na so too, wen two pipol sleep togeda, dem go fit make each oda body warm,
but na how one pesin fit take make ensef warm?
12 Dem fit attack and win one pesin wey stand alone,
but two pipol go stand fight kon win.
Na three pesin even betta pass,
bikos e dey hard to kut three rope wey dem tie togeda.
Wise Youth
13 E betta make yu dey poor and wise as youth, dan to bi old foolish king wey nor dey take advise. 14 Even if dem born dat youth for poor house or if e dey prison since, e fit kom out kon bi king for en town. 15 I don si for dis world as evribody dey follow one yong man wey dey lead dem afta di king die. 16 Even doh many pipol dey support am naw, anoda generashon go grow kon rijet am leta. So yu si, evritin dey yuzles and e just bi like wen pesin dey porshu breeze.