2
Nebukadnezzar Dream
For di sekond year wen Nebukadnezzar dey rule, e kon dream many dreams. Di dreams dey disturb en mind and e nor fit sleep, so di king kon sey make dem koll all di majishan; doz wey dey si vishon and di wise men, so dat dem go tell am wetin en dream mean. Wen dem kom, dem kon tell di king make e tell dem di dream.
But di king sey, “I nor fit remember wetin I dream and I nor know wetin di dream mean.” Di wise men kon tell di king for Aramaik language sey: “Awa king, make yu live forever! Make yu tell yor savants di kind dream wey yu dream and wi go tell yu wetin e mean.” Di king ansa di wise men, “I don tok for my mind sey una go tell mi my dream and wetin e mean. But if una nor fit tell mi di dream and wetin e mean, den I go make sure sey dem kut una to pieces kon skata una house! But if una fit tell mi di dream and wetin e mean, I go give una gifts. I go reward and honor una. So make una tell mi di dream and wetin e mean.” Dem tell di king again, “Abeg! Make yu tell us yor dream and wi go tell yu wetin e mean.” Di king ansa, “I know sey una dey try to waste time, bikos una si sey I don tok wetin I go do. If una nor tell mi di dream naw, na only one tin go happen to una. Una dey plan to lie give mi, bikos una bilive sey I fit shange my mind leta. So make una tell mi di dream and I go know sey una fit tell mi wetin e mean.”
10 Di wise men tell di king, “Nobody for dis world fit tell di king wetin e dream and know king don ever do dis kind tin to majishan, wise men or pipol wey dey si vishon. 11 Wetin di king dey ask for, nor dey eazy. Nobody for dis world fit tok di king dream escept di gods, but gods nor dey stay with human being!”
12 Bikos wetin dem tok make di king vex, e kon sey make dem kill and distroy all di wise men wey dey for Babilon. 13 So dem make law to kill all di wise men and Daniel and en friends dey join doz wey dem won kill so.
14 Den, Daniel go meet Ariok wey dey kommand di king bodyguard and na-im won kill dem. So e tok to am with wisdom. 15 E ask am, “Wetin make di king take dis kind wiked decision?” Den Ariok tell Daniel wetin happen. 16 Den Daniel go tell di king sey make e gi-am time and e go tell di king di dream and en meaning. 17 Daniel go house go tell e friends, Hananaya, Mishael and Azaraya wetin dey happen. 18 E kon ask dem to pray to God wey dey heaven make E for sorry for dem kon show dem di dream and en meaning, so dat en and en friends nor go die with di oda-wise men for Babilon. 19 For nite, God show and tell Daniel evritin thru dream. Den Daniel praiz God wey dey heaven 20 kon sey,
“Make wi praiz God name forever and ever,
bikos na-im get wisdom and pawa.
21 Na-im dey shange time and sizin;
dey make and distroy kings.
E dey give wisdom, undastandin and knowledge
to wise pipol.
22 All di sekret tins wey dem hide,
E dey bring am out;
E know wetin dem hide for darkness
and na lite E take kover ensef.
23 I praiz and honor Yu,
di Oga wey bi my papa dem God.
Yu don give mi wisdom and pawa;
Yu don ansa my prayers
kon show mi wetin I go tell di king.”
24 So Daniel go si Ariok (wey di king don tell make e kill di wise men for Babilon). E kon tell am, “Make yu nor kill di wise men for Babilon! Just take mi go meet di king and I go tell am en dream and wetin e mean!”
25 So Ariok kwik-kwik take Daniel go meet di king kon sey, “I don si one man wey wi karry kom from Judah, e go tell yu yor dream and wetin e mean.” 26 Den di king kon ask Daniel (wey en name na Belteshazzar), “Yu go fit tell mi di dream wey I dream and wetin e mean?” 27 Daniel ansa, “Di dream wey di king dream so, na dat kind dream wey wise men, pesin wey dey si vishon and majishan, nor go fit tok. 28 But, e get one God wey dey for heaven wey dey open sekret and tell dreams. E don tell King Nebukadnezzar wetin go happen for future. Dis na di dream and vishon wey yu si:
29 “As yu dey sleep for yor bed, yu kom dey tink of di future. God wey dey show pipol dream, don show yu wetin go happen. 30 Naw, God tell mi dis dream nor bi bikos na mi wise pass, but na to make yu my king, undastand wetin yu dey tink for yor mind.
31 “My king, for yor vishon, yu si one big image wey stand for yor front! E dey shine well-well and fear nor let yu look am. 32 Na gold dem take make di image head; en chest and hand na silva, while from en belle go down, na bronze. 33 En leg na iron, but en toe na both iron and san-san. 34 As yu dey look, one hand wey nor bi human being own kon kut one stone. Di stone fall on-top di image iron leg and di image kon skata to pieces. 35 Den all di iron, gold, silva and bronze kon bi like san-san for dry sizin. Breeze blow kon karry all of dem go and dem nor si dem again. But di stone wey skata di image, grow turn to mountin kon kover di eart. 36 Dis na di dream. Naw I go tell my king wetin e mean:
37 “My king, yu get pawa pass any oda king. God wey dey for heaven don make yu leader kon give yu pawa, strent and honor. 38 E don make yu ruler ova human being, animals and birds for dis eart. Na yu bi di head among all gold. 39 But afta yu, anoda kingdom go kom, dem nor go get pawa rish yor own and afta dat one, di third kingdom wey bi bronze, wey go rule di whole eart, go kom. 40 Den, di nomba four kingdom go kom and e go strong like iron wey go skata evritin to pieces. E go skata and distroy all di kingdoms wey dey before. 41 Yorsef si di leg and di toe wey dem make with iron and san-san. Dis one mean kingdom wey divide into two. Some of en pawa go bi like iron, aldo dem mix di iron with san. 42 Di toes wey dem make with iron and san mean sey, wen di kingdom don dey old, some part go strong and some part go weak. 43 Di san and iron wey mix togeda still dey show sey dis kingdom go try gada oda pipol join demsef thru marriage, so dat dem go dey strong, but dem nor go fit stay togeda just as iron and san nor fit mix. 44 For di time wey dis kings go dey rule, God wey dey heaven go raiz one kind kingdom wey nor go ever end. Dem nor go fit distroy di kingdom and anoda pesin nor go rule am. E go distroy and skata all di oda kingdoms. But dis kingdom go stand forever. 45 My king, yu si sey di stone kut komot from mountin, but nor bi human being hand kut am. E skata di iron, bronze, silva, klay and gold to pieces. God Almighty don show di king wetin go happen for future. I don tell yu yor dream and wetin e mean.”
46 Den King Nebukadnezzar bow face groun kon sey make dem sakrifice and offa ofrin for Daniel. 47 Di king sey, “Na yor God big pass among all gods! Na-im bi God of all kings and E dey show pipol wetin dey sekret and na-im make yu fit tok all dis tins so!” 48 So di king give Daniel high post with many fine gifts. E gi-am pawa for evry aria for en kingdom kon make am leader ova all di wise men for Babilon. 49 Daniel beg di king make e promote Shadrak, Meshak and Abednego, so dat dem go dey handle some issues for Babilon. Daniel, ensef kon dey serve for di king palis.