10
Angel Appear To Daniel
For di third year wen King Cyrus for Persia dey rule, God kon give Daniel (wey dem dey koll Belteshazzar) one message. Dis message na true, but e hard to undastand. Daniel undastand di message thru di vishon wey e si.
Before dat time, mi, Daniel dey mourn for three weeks. I nor chop any good food, meat, drink wine or komb my hair until di three weeks komplete.
For di twenty fourt day for di first mont, I stand near di great river, wey dem dey koll Tigris. I look up kon si one man wey wear linen klot: di belt for en waist na gold wey dem make from Ufaz. En body bi like yellow jasper and en face dey shine like lite. En eye dey shine like tosh; en hand and leg bi like bronze wey dem polish. En vois alone bi like sey na many pipol dey tok.
Na only mi, Daniel si di vishon. Di men wey follow mi nor si am. Dem run go hide, bikos dem dey fear. Na only mi dey der wen I si dis great vishon. I nor get strent again and my face kon shange well-well and anybody wey si mi nor go know sey na mi. But I hear as e dey tok and wen I hear dis vois, I just fall face groun. 10 Den one hand tosh and karry mi stand up well; but I still dey shake. 11 Di angel kom tell mi, “Daniel! God love yu. Stand up make yu listin well-well to wetin I won tok naw, bikos na God send mi kom meet yu.” Wen e don tok finish, I kon stand up, even doh I still dey shake. 12 Di angel tell mi, “Daniel, make yu nor fear. Since di first day wen yu honbol yorsef kon dey pray for undastandin, naim God don ansa yor prayers. So I kom as ansa to all yor prayer. 13 Di prince for Persia kingdom oppoz mi for twenty-one days. But Mikael, one strong angel for heaven kom help mi, bikos na only mi dey Persia. 14 Naw, I don kom help yu undastand wetin go happen to yor pipol for di future, bikos dat na wetin di vishon dey tok-of.”
15 As di angel still dey tok to mi, I sleep for groun and I nor fit tok. 16 Den di angel wey bi like human being, appear kon tosh my lip. I open my mout kon start to tok. I tell am, “Oga God! Dis vishon don make mi weak and na-im make mi dey shake anyhow. 17 I bi like savant wey stand for en oga front. Naw, how I won take tok to yu? I nor get strent to even breath again.” 18 Den di angel tosh mi again and my body kon strong. 19 E sey, “Make yu nor fear, God love yu well-well! So nor let anytin worry yu. Make yu dey strong! Wen e don tok like dis, my body kon strong more-more.” Den I sey, “Oga! Yu don make mi dey okay naw.” 20 Di angel sey, “Yu know wetin make mi kom meet yu? Naw, I won go fight Persia prince. Wen I don go, di angel wey dey guide Greece go kom.
21 “But I go first tell yu wetin dem rite for di book wey yu fit trust. (Nobody fit help mi against di prince, escept Mikael wey dey guide Israel.