7
Kweshon About Marriage
Naw I go ansa di kweshon wey una ask for una leta. Una ask sey, “E dey good make pesin nor marry?” But make una nor for dey do ashawo, e betta make una marry. Make husband and wife do di rite tin wey dem suppose do for one anoda. Nor bi di wife get en own body, but na di husband get am and na so too di wife get en husband body. Make una nor refuse each oda, escept una gri sey una go dey like dat for sometaim, so dat una go fit pray. Den Satan nor go fit tempt una, bikos una go fit kontrol una body. Na advise I dey give una, nor bi kommand. How I wish sey all of una bi like mi. But di gift wey God give us nor bi di same.
Dis na di advise wey I go tell di pesin wey neva marry and doz wey dia husband or wife don die; make una dey as una dey, just as I bi. But if dem nor fit kontrol demsef, make dem marry, bikos e betta make pesin marry, dan make e dey tink bad tin for en mind.
10 Na doz wey don marry I won give dis kommand to (Nor bi mi, but na God): Make wife nor leave en husband, 11 but if e leave am, make e nor marry again or make e go back go setol with di man. And make husband nor leave en wife too.
12 Even doh I dey tok on my own, I nor tink sey God go tok anytin difren from wetin I dey tell una about marriage. Di only tin wey I fit do na to give una my advise. If yor wife nor dey follow Christ, but e sey e go follow yu stay, make yu nor drive am. 13 If yor husband nor dey follow Christ, but e sey e go follow yu stay, make yu nor run leave am. 14 Bikos di husband wey nor bilive, God go save am, bikos of en wife wey bilive and di wife wey nor bilive, God go save am, bikos of en husband wey bilive. 15 But if di one wey nor bilive komot from di marriage, make e bi like dat. For dis kind kase, di broda or sista wey bilive, don dey free; bikos God wont make wi enjoy peace. 16 Yu wife! How yu take know sey yu nor go fit save yor husband? Yu husband! How yu take know sey yu nor go fit save yor wife?
Live As God Koll Yu
17 For evry church, I dey tell di pipol sey make dem remain as dem bi wen Oga God Jesus choose and koll dem to bi en own. Naw, na di same tin I dey tell una so. 18 If yu don already sekonsaiz, make yu dey like dat. If dem neva sekonsaiz yu, make yu nor sekonsaiz. 19 Weda dem sekonsaiz yu or not, nor mean anytin. Wetin dey important, na to obey God law. 20 So make una nor try to shange as una bi wen God choose una. 21 If God koll yu wen yu bi slave, make yu nor let am worry yu. But if yu fit get yor freedom, make yu get am. 22 Slave wey God choose make e follow Jesus, don bikom free man thru Jesus Christ. So free man wey God choose make e follow Jesus, don turn to Christ savant. 23 God pay big prize for una, so make una nor bi slave to any oda pesin. 24 Make una stay as una bi wen God choose and koll una.
Pipol Wey Neva Marry
25 Koncerning pipol wey neva marry before, I nor get any kommand from Christ to give una, but I go advise una as pesin wey una fit trust, bikos God dey show mi mesi. 26 Dis time wey wi dey nor eazy at-all and wetin I tink bi sey, e go good make una stay as una bi naw. 27 If yu don marry, nor leave yor marriage. If yu neva marry, make yu nor worry yorsef about am. 28 If pesin wey neva marry before kon marry, e nor sin. But, pipol wey don marry go face plenty wahala and I dey try to help una, so dat una nor go face dat kind wahala. 29 My friends, wetin I mean bi sey Christ go soon kom and e nor matter if yu don marry or not. 30 If yu dey kry or laf; dey buy sometin or yu nor get money, all na di same tin. 31 E nor go make any difrence even if yu get all di tins for dis world or sey yu like di world well-well, bikos as wi know, di world go soon vanish komot.
32 And I nor wont make anytin trobol una. Man wey neva marry, make e dey do tins wey go make Christ happy for am. 33 But man wey don marry get plenty tins to worry about. E go must worry about tins for dis world, bikos e go wont make belle dey sweet en wife, 34 so e go dey tink about difren tins. Woman wey neva marry dey only tink of how to make belle sweet Christ. Dat time, dia body and mind dey pure. But woman wey don marry dey worry about dis world tins, bikos e wont make belle sweet en husband. 35 Wetin I dey tok na for una own good, nor bi to make una slave. I wont help una to dey live betta life and to love Christ pass any oda tin.
36 But if yu get patina and yu nor fit kontrol yorsef, den make yu go marry. Nor-tin dey bad for dat one. 37 But e betta, if yu fit kontrol yor body sey yu nor won marry naw. 38 E dey rite and okay to marry, but e betta sey yu nor marry at-all.
39 Wife suppose to stay with en husband until di man die. Den e fit go marry again, but di new husband must bi pesin wey dey follow Christ. 40 But I bilive sey, I dey obey God Spirit wen I sey make di woman nor marry, so dat e go dey happy well-well.