4
Di Apostles Work
Make una dey tink about us as Christ savant wey God don show en sekret. God wont make wi dey faithful to am. So, e nor koncern mi if yu or any human kourt dey judge mi. Even mi nor fit judge mysef. My mind dey klear, but dat nor mean sey I dey innocent. Na only God go fit judge mi. So, make una nor judge anybody until Christ go kom back. E go espose evritin wey dey darkness and di tins wey dey inside pesin heart. Dat time, na God go praiz evribody akordin to wetin dem do.
My friends, I don use mysef and Apollos as ezample for una, so dat thru us, una go know wetin e mean to obey di law. I nor wont make una dey sey one of us betta pass di oda pesin. Wetin make una tink sey, una betta pass anoda pesin? Nor bi God give una evritin? So wetin make una dey boast wen e bi sey evritin wey una get, na God give una? Una don really get evritin wey una nid! Una don get plenty money! Una don turn king with us! How I wish sey una really bi king, so dat wi go dey rule with una. Bikos e klear sey, di place wey God give us wey bi en apostles, na where worse pass for di world; wi bi like prisonas wey dem dey go kill. Angels and dis world pipol just dey take us make yeye. 10 Bikos of Christ, pipol dey si us as fools, but God don make us wise. Wi weak and dem hate us, but dem dey respet una wey dey strong. 11 Even today, wi dey hongry for food and wota, na only rag wi get to wear. Dem dey trit us anyhow and wi nor get house to stay. 12 Wi dey work hard before wi go fit chop and as pipol dey curse us, na blessing wi dey give dem back. Wen wi dey sofa, wi dey-dey patient. 13 Wen pesin curse us, wi nor dey ansa back with kworel. So till today, dem dey si us as dirty for dis world.
Warnin From Papa To Pikin
14 I nor dey rite dis tins make una for shame, but na to korrect una as shidren wey I love. 15 Bikos even if 10,000 pipol kon tish una about Christ, na only one papa una go still get. Bikos una don turn to my pikin, wen una receive di message about Christ from mi. 16 So, I dey enkourage una sey, make una bi like mi. 17 Na to enkourage una make mi send Timoti, my son wey I like and wey love Christ kom meet una. E go tell una how I dey follow Christ and di tins wey I dey prish about Christ for evry church. 18 Some among una don dey karry body up, bikos una tink sey I nor go kom back again. 19 But if God allow mi, I go soon kom meet una. Den I go know if pipol wey dey boast, really get pawa. 20 Bikos God kingdom matter, nor bi about ordinary tok, but na about pawa. 21 Wish one una wont? Make I karry kane kom meet una, or make I kon show una di love wey di Spirit dey give pesin?