2
Paul Prish Wisdom
My brodas and sistas, wen I kom tell una about God word, I nor tok to una with big-big word or try to show sey I get sense. Bikos wen I dey with una, I plan sey, Christ wey dem kill for cross, na only en message I go tok to una about. So wen I kom meet una, I dey weak and dey fear. Wen I dey tok and prish to una, I nor try to show sey I get sense, but I dey do evritin with God pawa wey di Holy Spirit dey give, so dat una faith go dey for God pawa, nor bi human being wisdom.
God Wisdom
Wi dey tok with wisdom to doz wey really know God word, but nor bi with dis world or any ruler wisdom, bikos dia wisdom nor mean anytin. Di tin wey I dey tok about, na God sekret wisdom wey E choose for us, even before E kreate di world. No ruler for dis world fit undastand God wisdom, bikos if to sey dem fit, dem for nor nail and kill Christ wey get glory. But God word sey, “No eye don ever si; no ear don hear, even pesin mind nor fit tink about di tins wey God don prepare for pipol wey love am.” 10 God show us dis tins thru en Spirit, bikos di Spirit dey find evritin; even di deep tins wey dey God mind. 11 Na only pesin spirit know wetin dey di pesin mind and na only God Spirit know wetin dey God mind. 12 God give us en Spirit, so wi nor dey tink as dis world pipol dey tink and naim make us know di blessings wey God don give us. 13 Evry word wey wi dey tok, na God Spirit tish us and nor bi human wisdom. Na dis same Spirit dey help us tish spiritual tins to pipol wey get God Spirit. 14 So, na only who get God Spirit fit undastand spiritual blessings. Pesin wey nor get God Spirit, nor go fit undastand wetin di Spirit dey tok. 15 Pesin wey dey listin to di Spirit fit judge oda pipol, but nobody go fit judge dem: 16 bikos God word sey, “Who fit know wetin God dey tink so dat e go advise am?” But wi wey get di Spirit, undastand wetin Christ dey tish.