15
Jesus Resureshon
My brodas and sistas, I wont make una remember di gospel wey I prish give una, di one wey una asept and dey stand on. Na dis gospel go save una if una whole di message wey I prish give una well-well, unless una faith nor strong. Bikos na wetin I receive, naim bi di first important tin wey I give una; sey Christ die for awa sins as dem rite for God word and dem beri am, den God raiz am up afta three days as dem rite for God word. Christ appear to Pita, den to di twelf apostles. Den e appear to more dan five hundred bilivers. Some of dem still dey alive, but some don die. Den e appear to James, den to all di apostles. Finally, e appear to mi; even doh I bi like pikin wey dem born before di time rish, bikos na mi small pass among all di apostles. But, I kause many wahala for God church, so dem nor suppose koll mi apostle. 10 But God kind! I bi wetin I bi and God mesi for mi, nor bi yeye tin. I dey work pass any oda apostle; aldo na God grace dey help mi. 11 But e nor mean anytin if I prish or dem prish, as long as all of una bilive di message wey wi dey prish.
Awa Resureshon
12 Naw, if wi dey prish sey God raiz Jesus from deat, wetin make some pipol among una dey sey resureshon nor dey? 13 If resureshon nor dey, dat mean sey Christ nor raiz-up from grave. 14 And if Christ nor raiz-up, den awa prishin and una faith nor mean anytin. 15 So, if resureshon nor dey, dat mean sey, evritin wey wi don tok about God, na lie, bikos wi sey E raiz Jesus from deat wen E nor raiz am. 16 If resureshon nor dey, na-im bi sey Christ nor raiz-up from deat. 17 If God nor raiz Christ from deat, den una faith dey yuzles and una still dey inside una sin. 18 And doz wey bilive Christ before dem die, don lost bi dat. 19 Bikos if na only for dis life wi get hope for Christ, den awa kase worse pass any oda pesin own for dis world.
20 But God don raiz Christ from deat! And E make us dey sure sey, oda pipol go raiz-up from deat too. 21 Just as pipol go die bikos of Adam, na so too wi go raiz-up kom life, bikos of Christ. 22 Adam bring deat kom meet all of us, but Christ bring life kom. 23 But all of us must wait for awa turn. Na Christ God first raiz kom life and Christ go raiz en pipol wen e kom back. 24 Den afta Christ don distroy all pawas, di world go end and e go give di kingdom to God wey bi di Papa. 25 Christ go rule until e don put all en enemies under en pawa 26 and di last enemy wey e go distroy, na deat. 27 Wen God word sey, e go put evritin under en pawa, e nor mean sey, God dey among dem. Bikos na God put evritin under Jesus Christ pawa. 28 And wen evritin don dey under God pikin pawa, e go kon put ensef under God wey put evritin under en pikin pawa. Den God go kon bi evritin to evribody.
29 If resureshon nor dey, wetin make dem dey baptize pipol for Christ? 30 And wetin make us dey risk awa life 31 kon dey face deat evriday? Na di pride wey I get for una, bikos of awa Oga God Jesus Christ, naim make mi dey tok all dis tins. 32 If resureshon nor dey, wetin kon bi my gain, afta I don fight wiked animal for Efesus? Na bikos of pride make mi do am? If na so, e go good make wi dey chop and drink bikos tumoro wi go die. 33 Make una nor let anybody deceive una, “Bad friends dey spoil good karata.” 34 Make una get sense and stop to dey kommit sin. I still dey sopraiz sey some pipol among una nor know God.
Wetin Awa Body Go Bi Like
35 Some among una dey ask sey, “How pipol wey don die go take kom dis world back? Wish kind body dem go get?” 36 Una bi fool! Wetin pesin plant nor dey grow, unless di seed first die. 37 Wetin una plant, na ordinary seed, but na di full plant dey grow kom out. 38 Dis na bikos God dey give dem di kind body wey E wont make di plant get. 39 Pipol, animals, birds and fish, na flesh God take make all of dem, but all of dem get difren flesh. 40 As evritin for heaven get body, na so too evritin for dis eart get body. But one body difren from di oda ones.
41 Di sun nor bi like di moon; di moon nor bi like di star and di stars difren from each oda. 42 Na so e go bi afta wi don raiz-up from deat. Dis body wey wi get naw, go die, but di body wey wi go take raiz from deat, go dey forever. 43 Wen dem beri dis body, e dey weak and go rotin, but wen God don raiz us up from deat, di body go kon dey fine and strong forever. 44 As Fisical body dey, na so too spiritual body dey. And awa Fisical body go shange to spiritual body. 45 Di first man na Adam and God word sey, “Dis Adam na pesin wey God kreate like us. But Jesus, wey bi di last Adam, na pesin wey dey give life to pipol.” 46 Wi si sey di one wey get spiritual body nor first kom. E kom afta di one wey get Fisical body. 47 Na san God take make di first man, but di sekond man kom from heaven. 48 Evribody body for eart, bi like di first man and evribody body for heaven, bi like di sekond man own. 49 Just as wi bi like di first man wey kom from eart, wi go bi like di sekond man wey kom from heaven.
50 My friends, I wont make una know sey awa body wey get blood go rotin. Dat mean sey dis kind body, nor go fit enter God kingdom wey go dey forever. 51 I won tell una one big sekret: Nor bi all of us go die, but all of us go shange. 52 Before wi klose awa eye open am, e go don happen. As dem dey blow di last trumpet, all doz wey don die go raiz. All of us go shange, so dat wi nor go die again. 53 Awa body wey don die and rotin go kon shange to body wey nor go ever die or rotin. 54 Di body wey wi get naw, dey weak and e go die. But God go shange am to body wey go dey forever. So wetin dem rite for God word go kon happen sey: “Deat nor fit win di fight!”
55 “Yu deat! Where yor pawa?
Yu deat! How yu go take shaut sey yu win?”
56 Na sin dey make deat win and na di law dey kause sin. 57 So, make wi tank God wey give us viktory thru awa Oga God Jesus Christ. 58 So my friends, make una dey strong and nor let anytin shake una. Make una always dey do God work, bikos una know sey, evritin wey una do for God, get gain.