11
How To Woship God
Make una follow mi as I dey follow Christ.
I dey praiz una, bikos una always dey do di tins wey I tell una, but I wont make una undastand sey as Christ bi evribody head, na so too husband bi head for en house and na God bi Christ head. So any man wey dey pray or prish God message kon kover en head dey woship God, dey disgrace Christ. And any woman wey dey pray or prish God message and e nor kover en head, dey disgrace en head, wey bi en husband; e for betta sey di woman shave en head. If di woman nor one kover en hair, den make e go shave am. Man nor nid to kover en head, bikos e dey show as God glory bi. But woman dey show as man glory bi; bikos God nor kreate di man from woman, but E kreate di woman from man. God nor kreate man bikos of woman, but E kreate woman, bikos of man. 10 Bikos of di angels, di woman must kover en head to show sey na en husband dey protet am. 11 As wi dey serve Christ, di woman and di man, dey togeda for Christ body. 12 Aldo God make woman from man, but na woman dey born evribody, even doh na God kreate evribody. 13 Make una judge by unasef weda e dey good for woman to dey prish God word wen e nor kover en head. 14 Wetin make pipol for di world dey sey, na disgrace for man to karry long hair? 15 But long hair dey make woman fine well-well. God give di woman di long hair, so dat di hair go kover di woman head. 16 Dis na how dem dey do tins for God church, so nobody go fit follow mi kworel for wetin I dey tok.
17 Di way una dey woship God, dey kause wahala pass di good wey E dey do for una. Bikos of dis, I nor go fit praiz una. 18 Bikos I hear sey wen una gada dey woship God for church, na so-so kworel una dey kworel and I bilive sey some for wetin I hear, na true. 19 Bikos if una nor kworel, wi nor go know di good ones among una. 20 Wen una dey togeda, nor bi di Oga God Supper una dey chop? 21 But before evribody go rish di meetin, some pipol among una don start to chop and drink, wen odas dey hongry. 22 Una nor get house wey una go for chop and drink? Abi una hate God church? Una won disgrace pipol wey nor get anytin to chop? Wetin I go fit tell una naw? I nor go fit praiz una at-all.
23 I don already tell una wetin awa Oga God Jesus do for di nite wen dem sell am. And na Christ tok am by ensef. E take some bread for en hand 24 and afta e don tank God, e divide am kon sey, “Dis na my body wey I dey give una. Make una always dey chop am to remember mi.” 25 Afta dem chop finish, Jesus take di cup kon sey, “Dis na my blood wey God take make new kovenant with una. Make una always dey drink am to remember mi.” 26 Jesus mean sey, wen una chop di bread kon drink from di cup, una dey tell odas about Christ deat until e go kom back.
27 Bikos of dis, anybody wey chop di bread or drink di wine anyhow wey e like, dat pesin don sin against Christ body and en blood. 28 So make evribody shek ensef, before e chop di bread and drink from di cup. 29 But if una nor undastand sey na una bi Christ body, una don already kondemn unasef with di way wey una dey chop and drink from di cup. 30 Na dis make many of una wey nor well, weak and some among una don even die. 31 But if wi judge awasef, God nor go ponish us. 32 But wen God judge and ponish us, E dey do am, so dat E nor go kondemn us with dis world. 33 My brodas and sistas, make una dey wait for evribody, before una go start to chop di Oga God Supper. 34 But if anybody really dey hongry, make e chop kom from en house. Den wen una dey togeda, una nor go kondemn unasef. So wen I kom, I go tell una oda tins wey una suppose know.