28
Paul For Malta
Afta wi don rish land and nobody die, wi kon hear sey, na Malta dem dey koll di island. Di pipol wey dey stay for der trit us well. Dem make fire for us, bikos rain don start to dey fall and kold dey katch us. Wen Paul dey gada plenty stik make e put inside di fire, one snake wey dem dey koll, “Vipa”, kom out bikos of di heat kon put e mout for Paul hand. Wen di pipol wey dey stay der si sey di snake put e mout for Paul hand, dem kon dey tell demsef, “E bi like sey dis man hand nor klean! Even doh e nor die inside sea, hand don still tosh am for here!” But Paul shake di snake komot from en hand enter di fire and nor-tin do am at-all. But dem dey tink sey en body go swell-up or e go fall for groun die. So afta dem don wait for sometaim kon si sey nor-tin happen to am, dem kon shange mind sey, Paul na god.
Dat time for dat aria, Publius, wey bi di oga, get some land. E welkom us kon give us food for three days. Publius papa kon get fever and en belle dey pain am. Paul go si am kon heal am. Afta dis tin don happen, many pipol wey nor well for der kon still kom and e heal dem. 10 Dem kon dey praiz us well-well and wen wi won go, dem give us evritin wey wi nid.
Paul Rish Rome
11 Afta wi don dey der for three monts, wi kon enter ship from Alexandria wey stop for di island for kold time and di sign wey dey di ship front, na “Twins god.” 12 Wi stop for Syrakuse kon stay der for three days. 13 From der wi kon rish Rhegium and afta one day, one kind breeze from sout kon start to dey blow and di sekond day, wi kon rish Puteoli. 14 For der, wi si some brodas and dem kon beg us to stay with dem for seven days. Na so wi take rish Rome. 15 Wen di brodas for Rome hear about us, dem waka until dem rish “Appius Forum” and di “Three Taverns” kom meet us. Wen Paul si dem, e tank God and di tin kon make en heart strong well-well. 16 Wen Paul enter Rome, dem allow am stay en own house with di sojas wey dey guide am.
Paul Tok To Jew Pipol For Rome
17 Afta three days, Paul koll all di Jew pipol oga dem togeda. Wen dem don gada, e kon tell dem, “My pipol, even doh I nor do anytin against awa pipol or awa grand-grand papa dem tradishon, from Jerusalem naim dem turn mi to prisona kon karry mi give Rome pipol. 18 Wen dem don kweshon mi, dem won release mi, bikos dem nor si anytin wey go make dem kill mi. 19 But wen di Jew pipol nor gri make dem free mi, di tin kon make mi sey, I won go Rome make Caesar for judge my kase, nor bi bikos I get anytin wey I dey komplain against my pipol. 20 Bikos of dis, I kon sey I won si and follow una tok first sey, na bikos of di hope wey Israel get, naim make dem use dis shain tie my hand so.” 21 Di pipol ansa, “Dem nor send us any leta about yu from Judea and no one for awa brodas don kom from der kon sey yu dey do bad tins. 22 But wi go like to hear wetin yu dey tish from yor own mout, bikos wi know sey evribody for di whole world dey take mout kondemn dis group wey yu dey inside.”
23 Dem kon gri for di day wen dem go meet am and dem plenty wey kom en house kon meet am. So, from morning till evening, Paul kon dey esplain tins give dem. E dey tok about God kingdom and dey try to show dem wetin Moses Law and di profets tok about Jesus Christ. 24 Some among dem bilive wetin e tok, but some nor bilive. 25 So dem kon go, but dem nor gri among demsef afta Paul sey, “Di word wey di Holy Spirit tok thru di Profet Isaya, na true 26 sey,
“ ‘Una go meet and tell dis pipol sey,
“Una go dey hear, but una nor go undastand,
una go dey look, but una nor go fit si.
27 Una heart nor dey undastand
and una ear nor dey hear well again.
Devil don klose una eye, make una nor for fit si;
hear with una ears or undastand with una heart,
so dat una nor go fit turn kom meet God,
make E for heal una.” ’
28 “So make una know sey, dis salvashon wey God bring, dem don karry am go meet Gentile pipol, bikos dem go asept am!” 29 Wen e tok finish, di Jew pipol kon leave der dey vex among demsef.
30 So for two full years, Paul stay der for en own house wey e rent and e welkom all di pipol wey kom meet am 31 kon dey tell dem about God Kingdom. E tish dem with strong heart about Oga God Jesus Christ and nobody fit stop am.