19
John Di Baptist Disciples For Efesus
For di same time wen Apollos dey Korint, Paul travel pass inside town until e rish Efesus. For der, e meet some disciples kon ask dem, “Una don receive di Holy Spirit, since una don bilive Christ?” Dem ansa, “No! Wi neva even hear sey Holy Spirit dey.” Paul ask dem, “Na how dem kon take baptize una?” Dem ansa, “Na John baptizim.” Paul kon tell dem, “John baptize pipol wey turn from sin kom meet God with wota kon tell dem make dem bilive di pesin wey go kom afta am and na dat pesin, bi Jesus Christ.” Wen dem hear wetin Paul tok, dem kon baptize dem with Jesus Christ name and as Paul put hand for dia head, di Holy Spirit enter dem and dem kon start to speak difren language, dey profesai. (Na twelf disciples Paul follow tok.)
Paul Prish For Efesus
So Paul enter di sinagog kon dey tok with boldness for three monts. E dey show di pipol how dem go take bilive God Kingdom. But wen some sturbon pipol nor gri bilive, dem kon dey spoil Jesus Christ name for all di pipol front, so Paul with en disciples kon leave dem. Paul dey take en disciples follow body evriday, go tish for Tirannus Hall. 10 Dis tin kontinue for two years until evribody wey dey stay for Asia aria, weda na Jew or Greek, hear God word.
Skeva Seven Shidren
11 Dat time, God use Paul dey do many wonderful mirakles, 12 even handkachief and klot wey dem take tosh Paul body, dey heal sick pipol and drive evil spirit from pipol body, wen dem use am tosh dem. 13 But some Jew wey dey waka about kon try to koll Jesus Christ name for pipol wey evil spirit dey disturb dey sey, “I kommand yu with Jesus Christ name wey Paul dey prish.” 14 (So, Skeva wey bi Jew priest, get seven sons wey dey do dis kind tin.) 15 But di evil spirit ansa dem, “Yes! I know who Jesus Christ bi, I still know Paul too, but who una bi?” 16 Naim di man wey di evil spirit dey inside en body kon jump for dia body beat dem well-well, until dem start to beg. E beat dem till dem run komot from di house with nakednes and all dia body full with sore. 17 Wen evribody wey dey stay Efesus, both Jew and Greek, hear di story, fear katch dem and Jesus Christ name kon dey reign. 18 Pipol wey nor bilive, kom out kon dey konfess all di bad tins wey dem dey do. 19 Some wey dey do majik, bring all dia book kon burn dem to ashes for evribody front. Wen dem add di prize for all di book, e rish 50,000 silva koins. 20 So God word kon dey grow more-more and dem kon dey win many souls.
Rayot For Efesus
21 Afta all dis tins happen, Paul kon sey e go-go Jerusalem thru Masidonia and Akaia. E plan sey, “Afta I don rish der, I go still go Rome.” 22 So, afta e send two men wey dey help am, Timoti and Erastus go Masidonia, e kon still stay Asia small. 23 Dat time sirious wahala happen bikos of “Christ Way” wey dem dey prish. 24 E get one man, en name na Demetrius and e dey mold silva image. Na dis man mold Artemis shrine and dey help pipol wey dey mold, make plenty money. 25 Di man kon gada all di pipol wey dey mold, with oda men wey dey do dat kind work, den e tell dem, “My pipol, una know sey na dis business wi take dey chop. 26 And una don si and hear sey dis Paul don take many pipol komot from awa hand. Nor bi only for dis Efesus, but for di whole Asia, bikos e dey tell dem sey di gods wey dem mold, nor bi god at-all. 27 So, if wi nor do sometin, awa business go spoil and nor bi only dat one, but pipol nor go respet di temple wey awa juju, Artemis, dey stay again and dis woman wey di whole Asia dey woship, nor go get pawa again.”
28 Wen di pipol hear dis tins, dem vex well-well kon start to shaut, “Artemis wey dey Efesus, na yu bi awa god!” 29 Di whole town kon dey shake with nois and all di pipol rush go di stadium dey drag Gaius and Aristakus and di Masidonia pipol wey dey escort Paul. 30 But wen Paul one enter di stadium, di disciples nor allow am. 31 Even some for di oga dem wey bi en friend, send message go meet am sey, make e nor enter di stadium. 32 Na so all di pipol dey shaut anyhow and konfushon kon full evriwhere, many pipol wey gada dey shaut, nor even know why dem gada. 33 Some pipol sey na about Alexanda, bikos di Jew pipol don push am go front. Alexanda wave en hand kon sey, make dem kwayet, make e for fit tok to defend di Jew pipol. 34 But wen dem si sey na Jew e bi, dem kon start to shaut again, “Artemis wey dey Efesus, na yu bi awa god!” Dem shaut like dis rish two hours. 35 “Afta di town sekretary don make di pipol kwayet, e kon sey, My pipol wey dey Efesus, wish pesin dey among una wey nor know sey na Artemis bi Efesus god wey fall from heaven? 36 So bikos nobody fit argue dis matter, make una kwayet and make una nor do anytin wey nor get head. 37 Una don bring dis men kom here, nor bi bikos dem spoil di temple or curse awa goddes. 38 If Demetrius and di pipol wey dey with am get any komplain against anybody, kourt dey and judge dem dey der too. So make dem take dia kase go der. 39 But if una wont anytin wey pass dis one, na kourt dem go for setol am. 40 Bikos dem fit take all of us go kourt today sey wi dey rayot, bikos wi nor get any rizin for dis konfushon wey dey happen so.” 41 Afta e tok finish, e kon sey make evribody go dia house.